AN Open letter from A poor Man to The PRESIDENT in piDgin ENGLISH A must READ

Date: 22-04-2014 9:43 am (10 years ago) | Author: abdul mumin said adana
- at 22-04-2014 09:43 AM (10 years ago)
(m)
Dear mr president , i just wan beg you bros jonathan, i take all the gods of nigeria beg you, i take all the gods wey people dey hide worship beg you.i take GOD wey most of us dey worship openly beg you.i take the day wey dem  born you take beg you,i take all the things wey you like beg you. bros, as i dey write this ehn. na prostrate i prostrate for you ooh,i take all my heart beg you, i take my papa yam beg you, i use my papa cocoa plantain beg you, i take Anti- Party take beg you,say na 2015? no worry we go dash you till 2019, missing $20 billion, no be craze dey worry Sanusi Lamido. where him see that kind money dey miss, no mind am bros,we don commot our mind for that one too,we know even wan know how you dey take spend the oil subsidy money bros,spend am any how , na you be presido,
Even the almost one thrillion Naira for security sef, we don close our eyes bros,if you like , no do any road again,we no go ask you,
Fuel scarcity --?Huh? no worry bros, e don tay well well wey we don use to am. we sabi buy black market , abi people wey dey sell am dey from there dey get dem own chop no be we brothers? bros, even jobs sef, no worry your head for that one.na you send people make dem born plenty children? no worry we sabi struggle, Electricity? forget that one bros J, how many of we grand papas use electricity? den no live long? we go dey manage that one too,if we wan enjoy , we go dey use our Gencos, thank GOD say we never follow your advice say we throw them away.bros J, all these my beggin ehn, na one thing i need from you,
This one wey nigerians life no come even get value reach cockroach for oyinbo land own tire me ooh. bros , just use all your head and mind dey see how you go take dey protect us, we no need all those things wey we dey disturb you for,na long throat dey do us,just help us make we day sage bros,if you fit do that for us ehn -- i go join curse anybody wey ask you how you dey take spend we money,we no wan to dey waka dey fear say na next sound fit be the bomb sound bros,
We no wan to see fellow struggling nigerians dey roast like chickens wey oyinbo say them get bird flu,bros J, sebi you talk say you no get shoe?
E means say you too be one of us before before.if dem former leaders no protect you allow bomb finish you.sey you for reach where you are so tey you no fit no how many shoes you get,
GOD wey carry you reach there never resign ooh. and na HIM i dey take beg you make you do every thing to see say we too live oo, i beg bros J , no mind all those people wey say you no go continue,
Just protect our lives for us,na your hand soldiers , police all of den dey,use dem protects we poor masses na,no  be only bigg big men and women deserves to live safe,we too na life dey our body,and wetin fit make wey una dey where una dey so,we too fit reach there ooh, one ooh, but that one na only if we live ooh,
i take GOD beg you bros J,na beg i dey beg no be strong head oooh,
greet mama peace, abi wetin dem dey call her for me

Posted: at 22-04-2014 09:43 AM (10 years ago) | Grande Master
- papadip at 24-04-2014 05:16 AM (10 years ago)
(m)
 Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin
.......it will be very good for a satirical cartoon or  a short play....
I may just do that if I am able to reference the author.....
and upload the damn thing on Youtube.
Posted: at 24-04-2014 05:16 AM (10 years ago) | Gistmaniac
Reply
- ajanni at 24-04-2014 06:23 PM (10 years ago)
(m)
permission granted
just do that now for the benefit of all
 Grin Grin Grin
Posted: at 24-04-2014 06:23 PM (10 years ago) | Grande Master
Reply
- papadip at 30-04-2014 04:16 AM (9 years ago)
(m)
Quote from: ajanni on 24-04-2014 06:23 PM
permission granted
just do that now for the benefit of all
 Grin Grin Grin
It wouldn’t be right away… I need to get some voice-overs.
Hopefully I’ll get some from some kids in the summer.
Plus I need to spice it up a bit.

Seriously it is worth doing well for the benefit of all concerned.

Posted: at 30-04-2014 04:16 AM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- ajanni at 30-04-2014 04:18 PM (9 years ago)
(m)
alright
goodluck but not jonathan
Posted: at 30-04-2014 04:18 PM (9 years ago) | Grande Master
Reply

fire TRENDING GISTS fire

TODAY'S TOP
  1. "Emefiele, Kanu Arrested Arbitrarily As Pre-Trial Detention Persists In Nigeria" – US Govt Says

  2. Popular Ghanaian Media Personality, Serwaa Amihere Finally Reacts To Her Leaked S3x Tape

  3. Passengers Stranded, Flights Disrupted as Fire Breaks Out at Lagos Airport

  4. Shops, Residential Houses Demolished by Ebonyi Govt For Construction of New Flyover

  5. Actor, Zubby Michael Finally Mourns Late Colleague Junior Pope, Netizens React

  6. I Saw it Very Clearly - Nigerian Pastor Insists World Will End Today, April 25th

  7. Oyo State Government Declares Friday Half Working Day For Local Govt Election


THIS WEEK
  1. Davido Reveals Fate of Peruzzi And Other Signed Artistes After Dissolving DMW Record Label

  2. Abia Police Parade Suspected Criminals, Including ABSU Student Involved In Fatal Shooting

  3. 'Brand Ambassador', Phyna Calls Out Pepsi For Supplying Her Expired Drinks

  4. How Past Abia Govt Paid N107.2 Bn To Contractors For Non-existent Abia Airport & Other Projects

  5. Lady Who Was Dragged For Wearing a Racy 'Asoebi' Outfit to a Wedding Reception Breaks Silence

  6. Ex-Nigerian Customs Sole Administrator, Omlago Ango Damages Estranged Wife's Abuja Home

  7. Lady Who Left The UK With Her Family to Return Home to Nigeria Reveals Why She Did So

  8. UNIPORT Lecturer Caught on Camera Pants Down, S3xually Harassing a Female Student in His Office

  9. VID: Peter Obi Replies Critics Asking Him Why He Didn't Build a School in Anambra as a Governor

  10. Abia State Police Arrest Suspects Linked To Mysterious Death of 23-Yr-Old Hope Chinedu Prosper


TOP MEMBERS: