Only in Nigeria

Date: 12-03-2016 12:26 pm (8 years ago) | Author: victor matt
- at 12-03-2016 12:26 PM (8 years ago)
(m)
Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading #200
MTN Recharge Card.
Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship.
Then Airtel go com follow sey, recharge #100 an win benin
republic. =D
Glo, go just kuku say… Recharge 500 and win Nigeria
because their colour na Green
Na only for Nigeria you go see fish inside”MEATPIE”
Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw
am from ATM because we no even trust ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey sey: Win a brand new
GENERATOR if you pay your light bill (What a pity!)Cheesy
Na only for Naija people dey horn for traffic light make e
quick change from Red to Green.
Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card,
Chin chin, Puff puff and beer.
Wetin you u no see for Naija, you no fit see am anywhere in
d world… Trust me.
Abeg na joke o, no take am personal O =))
I love Naija! Proudly Naija! just for laughs o… add your own jare

Posted: at 12-03-2016 12:26 PM (8 years ago) | Hero