10 STUPID QUESTIONS PEOPLE ASK IN NAIJA....xxx

Date: 13-03-2016 2:01 pm (8 years ago) | Author: Emma Uchenna Isibor
- at 13-03-2016 02:01 PM (8 years ago)
(m)

1. You see identical twins, you
still dey ask 'na twins be dis'?
No bros, na picmix...lol
. 2. Nepa brings light and
everyone in the
neighborhood
shouts 'up Nepaaa'! My guy ask
me, O boy na light be that?
No oh, Na Holy Ghost fire! Lol!
. 3. You see person dey vomit,
you
still dey ask am 'you no well'? Em
well, e juz dey
practice how
to vomit.
.
4. You just wake up from sleep
person
come ask you "you don
wake?" No oh, I come buy bread
wey I go
chop for dream.
.
5. You see woman wey born new
pikin u
ask her "madam u don
born? " No ohhhh, she buy am
for OLX...
.
6. You greet person "good
morning ma" ! She ask, my pikin
you don
wake?Huh?
no ohhhh, I dey sleep walk... .
7. My guy ask me "O boy where u
dey?" I tell am say i dey bank, nd
him ask me "Wat is happening
there?"
Nah new yam festival.. *LMAO*
. 8. My neighbour sees me
opening the gates to drive out
and asks me, U dey comot? Not
at all... I
be the new
gateman...
. 9. I dey watch film… my guy
enta
come ask me "Guy na film u dey
watch? No naa... I dey discuss
with
Osuofia...
.
10.U see me dey chop indomie
come dey ask me, O
boy, na
indomie u dey chop so? No
ohhhh... Na
fried rubber band
mixed with thread.
.
As it stands now, abeg i need to
ask u one question,
no vex abeg.
Shey na WhatsApp be dis???

Posted: at 13-03-2016 02:01 PM (8 years ago) | Hero
- BournIdentity at 13-03-2016 06:18 PM (8 years ago)
(m)
I saw
Posted: at 13-03-2016 06:18 PM (8 years ago) | Addicted Hero
Reply
- emma4love3 at 14-03-2016 06:25 AM (8 years ago)
(m)
na so oooh...
Posted: at 14-03-2016 06:25 AM (8 years ago) | Hero
Reply