Ruggedman : Eh hen

Date: 26-01-2008 7:04 pm (16 years ago) | Author: King Samuel O Dguy
- at 26-01-2008 07:04 PM (16 years ago)
(m)
Talking

Chorus
Ehen, why you too dey rap like Mumu? (2x)
Ehen, wetin concern Dudu and Fufu?
Ehen, God don catch you somebody don blast you
Ehen, why you too dey copy copy? (2x)
Ehen, abi your name na floppy floppy?
Ehen, God don catch you
Ruggedman don blast you
Good for you

Verse 1
No more games
I go go straight
I go name names
I no go lay blame
Na time to flog with cane
I go let you feel pain and shame
If I leave you and you still dey yarn your stupid game
Dey shout your name
Like say na something good
You disrespect?
If you rude, I go slap you right here
I no go wait for any mood
Now Rasqie, how you take get deal pass me
I no know wetin Kennis been hope to do by signing you
Why?
Ba lyrics, ba sense ba concept
wetin e get?
Nonsense
You even talk say fakers dey out there
Out where?
Sey where you stand?
Okay, yeah!!!
See kettle, calling the pot black like the Reverends
''Ayangba'' na another point of reference
but I go take una one by one
Cos even the sun and the moon dey take am
''turn by turn''
As long as my wheel dey turn, my fire go burn
I go call your name no matter where you are from
Or who you roll with or who you flow with
No blame me I only see you as wetin you spit
So if I call Rasqie a ras kid
I know wetin I speak so make anybody no harass me for street
If you do, e go too bloody
Cos my dogs dey with me some of them high pass Whitney and Bobby put together
Rock for the butter, the bread, the cheda, whenever...mmh..
in short for ever
You see me dey come through
You best dey run too
Cos ma crew's gonna run through you like a runaway
''Choo Choo''
If you like the beat ''Gbon idi''
Rasqie do the track but him gan him no soji
I say if you like the beat ''Gbon idi''
Rasqie do the track but him gan him no soji

Repeat Chorus

Verse 2
No be secret say Remedies been need remedy
I hear their rap I laugh to me na like comedy
Eedris and my five year old nephew rap the same way
Like say dem born dem on the same day
Wetin him dey talk I no hear
But I fear when him migidi and people start to cheer
I say wetin him dey try say for so long?
Him name na Eedris
How come him sabi speak in tongues?
I speak too strong to be lyrically weak
so if I die na of lyrics I go dey reek
So Eedris, here's a word of advice
Try using words and you just might sound nice
But not as precise as me and my guys in front of your eyes
No try too hard cos we don already win the prize
So no need to rush to grab the mic to dey bust
No need to ............to step on stage just because
Ti wa abinibi
Tie ability
so make u no show your face for my vicinity
with your migidi…
We fit make money before this year over
By selling tapes and an Eedris opats decoder
I say
We fit make money before this year over oh.
By selling tapes and an Eedris opats decoder

Repeat Chorus

Verse 3
Oya Maintain
Make we sit down, make we yarn
I loved your concept for ''Blah''
Your video bam
But after that, nothing else
Ninety percent of your whole album na from someone else
Tune no be your own
Instrumental no be your own
But thank God concept and language na your own (Yoruba)
But how far with copy copy and over lifting?
Outside of Naija copy write law go be your in thing
Your main issue
Record companies dem go rip you like tissue
So where you think say that go leave you?
Inside gutter
And I sure say Bamo go scamper
When katakata scatter yakata
This no be beef talk
Cos if na im we go be topic
Wey market women go dey discuss for race course
Oya, make we pause

Imagine Maintain for Yankee say dem wan perform
LL Cool J,Nas,Aaliyah wey don kpai

Talking

I love you guys and I know you got stuff to offer
Only, keep it original take ma words like a brother
See me like a Pastor putting y'all on the right path
Ke de mail me nitori mo fe ka jo se track (e mail me oh!)

Repeat Chorus

Talking


Posted: at 26-01-2008 07:04 PM (16 years ago) | Gistmaniac

fire TRENDING GISTS fire

TODAY'S TOP
  1. BREAKING! CBN Increases Capital Base For Commercial Banks

  2. I Have No Hand in The Killing - Delta Monarch Cries Out After Being Declared Wanted by The Army

  3. Newly Wedded Wife Bathes Husband With Hot Water For Stopping Her From Making Calls

  4. Yul Edochie Takes His Second Wife, Judy Austin To His Village In Anambra

  5. Woman Shares Text Message She Received From Her Father After She Missed His Call Twice

  6. AGAIN! Nigeria Thrown Into Darkness As National Grid Collapses Ahead Of Easter Holidays

  7. Renowned Nigerian Playwright, Wole Oguntokun Is Dead

  8. How Woman Suffered Organ Failure From Hair Cream Which Caused Her Kidney To Shut Down

  9. 17Yr Old Girl Raped And Strangled To Death By Her Cousin In South Africa

  10. 400L Nasarawa Varsity Student, John Rudeh Declared Missing After Palliative Stampede

  11. 'I Can't Drive Any Of My Kids Away If DNA Test Shows They're Not My Biological Children' - Man


THIS WEEK
  1. Russia President Putin Shocks Many As He Announces That Jesus And Mary Were Black

  2. Netizens React To Influencer, Enioluwa’s Alleged Leaked S*x Tape

  3. Kim Kardashian Finally Opens Up On Why She Divorced Kanye West

  4. Selena Gomez Shares Sexy Photo As She Put On A Very BUsty Display

  5. Man Videos Himself Taking His Own Life on Facebook Because His Girlfriend Cheated on Him

  6. Photos: Customs Officers Attacked By Suspected Smugglers In Adamawa

  7. "Why I Broke Up With My Girlfriend When I Became A Star" – Singer, Asake

  8. FAAN Shuts Down KFC Outlet At The Lagos Airport Over Discriminatory Treatment of Ex Gov's Son

  9. 44Yr Old Bassirou Faye Wins Senegal's Presidential Election, Defeats 62Yr Old Ex Prime Minister

  10. Stop Harassïng Enioluwa, I'm The One in The Leaked S*x Tape - US P0rn Star, Briggs Speaks (VID)


TOP MEMBERS: