I greet una ooo! my naija people, una still dey tuk about super fly and super hen?. Well anytin wey una call them no be my wahala, me my own be sey dem live training and ball wey carry dem go oyibo town, go dey chop everytin wey dem see so tey dem fat reach where dem no fit kik empty pure water wey dey for inside 18 yard box, dat one na big shame. Coach eye dey swell, him no dey fit see who him go change, O! well, their name na super struggle dem go struggle win Mozambique 1-0 as usualooooooo!!!!!! |