Omo guy, you come dey celebrate virginity with beauty pageant at d same time. You nor sure say d two na opposite and nor fit work together. So, u want de virgins to waka in front of men wit wolf eyes. I bet u d lives of dos girls will not be desame again! Dey will be 'disroyalized'.You for find one ogboge traditional show where virgins go fit walk tall and safe as virgins.... By d way. You say 65 virgins! How u take gather dem. Let me also add - For Africa society, small pikin, na small pikin-o. But 16 years pikin wet e don mary nor be small pikin again-o. The test of virginity de carry weigt wen bi say na de man wen papa and mama don gree make him marry de girl, sleep with am. Infact, de man wen find out say de girl na virgin, different traditions tell us say na different way e take dey tel d parents thank u. Dis your own, u just go carry girl dem wey de waka gbraka, gbraka for road go meet dockita for test. Wetin go happen wen John go marry one of d girls in two years time and e come find out say d place na express road! John fit sue u-o! Well, me I know say u just dey do dis your show becos of d way society do spoil. Keep trying broda. |