Show Posts
Pages:
1  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Sex Workers In Ghana Protest Against Nigerian Invasion NA WAOOO on: 3-09-2010 03:39 PM
Naija girls una toomuch so una don go Ghana go dey do competition for selling sex and even carry the cup there,please Naija i hail una,na una be really the giant of Africa no be for good thingsooo na giant for bad thingsooo cos when it comes for JuJu na una carry cup,for 419 na una carry cup, for money ritual na una carry cup,for fake pastors na una carry cup, for bad government na una carry cup,for bad road na una carry cup for corruption and bribery na una carry cup even marketing of sex na una carry cup just to mention few, please my respect to u people na una biko una toomuch.But make una remember that God no dey laugh now, His annoyance is seriously heavy on this earth but more on naija people.
2  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Sex Workers In Ghana Protest Against Nigerian Invasion NA WAOOO on: 3-09-2010 02:53 PM
Na waooo see where people dey use bad thing dey make mouth and even dey fight over it, I thought it is only naija people dey produce bad things so even Ghana of all people go fit go this far in bad thing like this, That mean Ghanians are very good in learning bad thing fastooo no be only naija people, Abeg more grease to ur elbow, una no the shame, Make una nknow sey God dey for road dey comeooo.
Pages: