Show Posts
Pages:
1 ... 4 5 6 [7]
121  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: 2nd Bomb explosion rocks Abuja on: 1-01-2011 10:17 PM
A COUNTRY WHERE JONATHAN NA PRESIDENT, DEM CARRY YARADUA DEATH BODY COME BACK FROM SAUDI ARABIA, HE NOY KNOW, NAI HE GO COME SOLVE BOMB BLAST PROBLEM, NA WA NIGER UNA FUNNY NOY BE SMALL, INDEPENDENT DAY BOMBLAST, JONATHAN KNOW WHO DO AM HE NOY AREST THE PERSON, I BEG WE NOY GET PRESIDENT, MAKE HE GO BACK TO BAYESA STATE GO FISH OR MAKE HE GO MEET TIMAYA MAKE DEM GO PLAY MUSIC TOGETHER. YEYE PRESIDENT.
122  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: 2nd Bomb explosion rocks Abuja on: 1-01-2011 10:03 PM
PEOPLE DEY SAY JONATHAN SLOW, WHY HE NOY GO SLOW WHEN HE DEY TAKE ORDER FROM PDP, HE NOY FIT TAKE DECISION ON HIS OWN, THEM DEY USE AM, WHEN DEM DON TIRE WITH AM FINISH DEM GO DROP AM. MAKE UNA NOY THINK SAY HE GO WIN ELECTION FOR NIGER? FA FA FA FOWL, NA BIG LIE, JONATHAN NO GET THE, MIT FOR NIGER POLICTICS, EVEN ABIOLA WEN HE GET BIG MIGHT WITH HIS CONNECTIONS, DEM NOY GREE AM MAKE HE RULE, DEM KILL AM LIKE CHICKEN. EVEN SOME NIGERIAS DONT EVEN KNOW WHO BE PRESIDENT OF NIGERIA, I ASKED SOME FEW ONES ABROAD DEM NOY AM AT ALL. TELL ME WETIN HIM AND YARADUA DO FOR NIGER SINCE? COMMON ELETRICITY DEM NOY FIT GIVE US. WHEN BUHARI AND IDIAGBUN COME FOR JUST 6MONTHS NAIJA CHANGED JUST SIX MONTHS, IDIANGBUN NA VICE OO ABI? BUHARI NA HEAD OF STATE. JONATHAN DEY THERE AS VICE HE NOY DO ANYTHING, EVEN AS PRESIDENT, HE NOY DO ANYTHING, PEOPLE DEY HERE THEY TALK RUBISH SAY JONATHAN WE ARE BEHIND U. BUT DEM NOY KNOW SAY NA IBB HISELF NAI PUT AM THERE, DEM DEY THE SAME PARTY ABI, ABI NOY BE DE SAME PARTY THEM DEY I BEG MAKE UNA TELL ME.? WHY RIBADU NOY JOIN PDP NA? UNA THINK SAY THE MAN NOY GET SENSE? PDP NA WHERE THE BAD POLITICIANS DEY EVEN MARADONA IBB NA THERE HIM DEY TOO. SO HIM AND JONATHAN DEY CARRY THE PARTY CARD. BIRD OF THE SAME FEATHER OYIBO TALK SAY FLOCK TOGETHER. MAKE WE NOY DEY DECIV OURSELVES AGAIN, MAKE UNA ANSWER THIS QUESTION. WHICH PARTY IBB AND JONATHAN DEY? U DON SEE WHERE A PARTY MAN GO AREST HIS OWN PARTY MAN B4? NA WA FOR NIGER PEOPLE OOO
123  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: 2nd Bomb explosion rocks Abuja on: 1-01-2011 09:40 PM
 WHEN NIGERIANS GO GET SENSE SELF? I BEG MAKE UNA TELL ME. UNA DEY SHOUT JONATHAN, DO SOMETHING JONATHAN DO SOMETHING, UNA NOY KNOW SAY JONATHAN WITH THEM BE THE SAME. WHEN DEM MAKE YARADUA PRESIDENT, DEM HOLD MEETING MAKE THE TAKE JONATHAN TO BE VICE SO THAT NIGER DELTA PEOPLE NOY GO FIGHT AGAIN, JONATHAN NO PREPARE TO COME BE VICE B4, NA BY CHANCE, NOT TO TALK LESS BEEN A PRESIDENT. MAKE WE REASON, PEOPLE WEN PUT AM THERE WANT AM TO COMOT NOW. THEM PUT AM THERE TO COVER UP FOR THEM. WE NO THINK WELL WHY DEM GO PICK JONATHAN FROM BAYESA STATE? BECUS THEY THINK SAY THAT ONE GO SOLVE THE NIGER DELTA PROBLEM BECUS THEIR BROTHER DON DEY THEIR. JONATHAN NA FIGURE HEAD THERE AS A PRESIDENT, HE NOY FIT TALK CUS IF HE TALK OR ARREST ANY UNTOUCHABLE HE SECRET GO LOOSE. JONATHAN NOY BE OUR MASIAH, NA EXTENSION OF YARADUA GOVERNMENT NA THE PARTY  MANIFESTO HE DEY FOLLOW PDP. IF JONATHAN TRY ARREST IBB OR ATIKU, DEM GO COMMOT THERE. NA IBB HIMSELF PUT OBJ AND ATIKU THERE, WHEN DEM WON COMOT DEM SINGLE HANDEDLY PUT YARADUA AND JONATHAN THERE. JONATHAN NOY DEY THERE WHEN DEM REMOVE RIBADU AS EFCC CHAIRMAN, WHY HE NOY RESIGHN AS VICE PRESIDENT, WHY HE NOY RESIGN MAKE UNA TELL, HE NO SAY YARADUA DON DIE, HE CALL RIBADU BACK SAY MAKE HE COME BE AIGP AAGAIN, WHY HE NOY MAKE EFCC CHAIMAN AGAIN? BECUS RIBADU GO TOUCH THE UNTOUCHABLE. DEM DEY FOOL US,  JONATHAN DEY FOOL HIMSELF, WHO BELIVE IN JONATHAN NA MUGU IN THE HIGHEST LEVEL.
124  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Nigeria First Lady Makes Another Bad Grammatical blunder on: 25-12-2010 01:41 AM
why be say na soso yeye tins nai dis guy dey post self, na u still the lesbian stuff, again u don post first lady wrong speach. na grammer be our problem for niger? i beg uu ur leave her alone, soon na lesbian u go call her oo. u noy get work this man.
125  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Hon. Patrick Obahiagbon Comments On Death of Pa. Enahoro on: 19-12-2010 08:13 PM
Quote from: mediaexcell on 18-12-2010 02:46 PM
  I BEG U SAID IT ALL. EVEN WOLE SOYINKA SPEAKS WE UNDERSTAND, THIS IS JUST MADENESS. EVEN THE ENGLISH PEOPLE WHO THOUGHT ENGLISH HE CANT SAY HE SPEAKS BETTER THAN DEM.
Quote from: Abby on 18-12-2010 02:22 PM
This man has problems and he is definitely not a leader.  Who can say the understood what they have just read?  You have an idea but you do not understand. The average English person, even an English professor in England would not understand this fluently. Spare me the talk about me being angry because I didn't do to school or I cannot understand him, I am not even fronting I do not understand him and that is the problem.

ok so yes he has the knowledge of big words but he does not have the wisdom to apply them properly. Who uses so many big words in a paragraph? in a sentence?  An average person knows the importance of COMMUNICATION, even a person below average understands it. You talk to people in the language they understand, or you use the words they understand; basically talk to people in the way that they would understand. This dude with all his knowledge of big words does not understand that, I say he has the knowledge fine, but he lacks wisdom and he is not an intelligent man.

Why do we keep falling for bullshit like this? This man is as useless as all our other leaders and people are quick to praise him for his excessive use of words that they do not understand   Huh?  So he is leader right, how does he communicate with his people?  That is basic, leaders should have good communication skills, this guy has none... how do they communicate? The average Nigerian, even they ones above average do not understand what he is saying, so what is the point?

He may have something important to say or the things that he means to say are good, but his presentation totally takes away from it. For example, no one is talking about how nice the things he said about Anthony Enahoro are, most of the comments here will be about the words that he used, on his YouTube videos most of the comments are not about how much sense he makes or how intelligent he is because of the solutions he offers or the things he talks about, it is about the words he used or how intelligent he is because he threw a lot of big words together that they do not understand. His act, because that is what it is I refuse to believe he cannot speak any other way, completes takes away from his message.  No one needs a leader like him, he is a joke. Someone said ‘they’ must have put him there to make them laugh, I would not be surprised, that is the only result he gets. 

What is he trying to prove?  Tony Blair, Barack Obama and other leaders, people understand what they are saying... and maybe he should also try learning how to pronounce the words properly while he is a worrying about how much big words he knows. At first I use to laugh, but it is not funny anymore, this guy is a leader, he is in the house if rep... tomorrow he will want to be a president as someone suggested  Huh?  and those trousers?  this is really a joke, a gimmick either that or he has serious issues

are u his daughter,?,this ur own need summary,,y didnt u make it atleast three pages this one small na,
126  Forum / Politics / Re: Dora Akunyili Quits Jonathan Cabinet To Join Politics on: 16-12-2010 08:33 PM
Quote from: kush_360 on 16-12-2010 07:14 PM
Well who no like better thing? Nigeria lawmakers are one of the highest paid lawmakers in the World. Little wonder why mama won Senate
             God bless u my brother, u said it all. some people are blind they cant eye, some will see the truth but cant say it. dem be highest paid in the world u are right, and that place is the engine room for curuption in niger oo. the share money every  time dem meet there. so she can never be the same woman again. oyibo say bird of the same feather fly together my brother. wen niger go open eye?
127  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Should I tell these men all I want is sex? on: 15-12-2010 10:04 PM
Na wa for guys ooo. wish one una dey self, some one won give us for free una dey vex shoo. na donatus she be na, i be u o girl tell me how i go meet u iam interested. warri boy noy dey carry last
128  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: US deports 80 Nigerians weekly, says cleric on: 15-12-2010 09:58 PM
why una self dey follow women ague here, una know say na lie lie dem like, and that lie lie nai we take dey catch them, I beg una make una live BARBIE  alone make she believe the story. na today? america movie.
129  Forum / Politics / Re: Dora Akunyili Quits Jonathan Cabinet To Join Politics on: 15-12-2010 05:07 PM
uuuhh na big mistake she do oo, i beg, if she won serve her people proper, why she no go for governorship election, secondly senate decision based on the final agreement by members oo. why she noy go where she go get autonomous power, when their people know say na the most curupt state 4niger, fake drugs, ritual, robbery, kidnaping, dey there? their people know say if she be governor, she go spoil business for them, thats why she won go for senate. or she feel say she too big to be a governor after she don be minister, fa fa fa fowl, na greed dey worry her, she won go collect the fat salary wen dem they collect their too. na wetin dey her eye. russian former president PUTIN when he finish him term, becus of he good work he do de president wen come again still come make am prime minister to continue his good job.  if Dora they sincere why he noy lobby for key position to help nigerias, efcc dey there, nnpc dey there, all the key position where our money dey pass dissappear. DORA na lie oloju kokoro nai dey worry u, u won go colley one hundrend fifty million a month. na TAI SOLARI style u won use na.
130  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Nigerian Parents Paid Rick Ross $100,000 To Attend Son's Birthday on: 15-12-2010 02:00 AM
 una see how nigerians dey bloody fool their self, even the rapper na yeye monkey, that man rich pass who give am that money if he noy know, when motherless children dey there, no one help dem, he won show off, if na money he work with his own hand, money he sweat for, he fit  give am out like that, becus na government money. oyinbo noy go call 50 cent with five thousand naira, becus he don already watch am  for tv and video. nobody wen suffer for him money fit give away like that. na the category of the x kogi governor be dat, dangote and adenuga noy go do that kind tin.  make una dey bring topic how nigeria go good noy be yeye topic how some thief spending our money.
131  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Former First lady Rendered Homeless America on: 14-12-2010 09:58 PM
efcc plssssssssssss i beg una make arrest quick quick, abi una noy see the picture of the house? na small one una see so, LAWRENCE ANINI steal small money, una cut him leg, tie am for stick shot am die, the one we dey see so  noy pass wetin ANINI Steal? why dem noy kill de barawo, anybody wen pitty dis woman and her children na barawo too. all the ministers, governor, president commisioner wen don rule our country b4 wen steal money, make ogun kill dem and their children patapata. GOD GOD GOD hear our cry oooooo :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'(
132  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Former First lady Rendered Homeless America on: 14-12-2010 09:36 PM
Na wa for nigerians ooo, so una dey pity the woman? wen we go get sense, i say wen? as we hear dis story we supos to call efcc to arrest the former governor make he xplain where he get all this money wen he take buy palace for america uk and saudi arabia, and alot of houses in abuja and lagos. kongi state as i know na very poor state, all the money wen he supose to take build hospital, schools, good road nai dis man thief. OBAMA noy get house reach this man oo, na only one house ABAMA still get oo even as a presidor, nai one yeye ilitrate steal moni go buy houses every where and una dey pity the children, the same children when dem grow up dem go be thief like their papa dey opress our own children too. dem pass the stealing from generation to generation. people dey sleep under brige for oshodi, una dey pity thief thief family, una noy pray make the woman die with all her children self una dey talk rubish. even with the xgovernor. if na babagida wife he happen to, na so  una go dey pity am too, na wa for nigerians oo, all their pikin dey go better school abroad, schol strike for nigeria eno concern dem, if dem sick na abroad dem carry d children go for treatment,  una dey here  dey pitty first lady wen be thief. nemesis dey catch up with dem, why una noy pity JAMES EBORI na, una 4 pitty am too. i noy won swear here oo, person wen get wife and children noy pity her, una come dey pitty, i beg make dem go die for cold, make nigeria for better.
133  Forum / The Buzz Central / Re: Nigerian Comedian (Ali baba) buys truck head for N20M (180,000 USD) on: 13-12-2010 07:37 PM
na today, america movie, warri boy go buy truck for 20m, una noy  know ali baba at all. if ali baba won invest that kind money, he go buy ship, when he go take do bunkry for waffi. na today we buy monkey for play. we noy dey carry last
134  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Nigerians to get new ID cards on: 13-12-2010 05:53 PM
na id be our problem thiefs, no light, no good education, no health care, no security, una dey talk of id card again, the one we do b4 we noy see am. 5billion naira disapear fiaam Na God go punish una.
135  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: We’ve recovered over $1.5bn from Ibru – EFCC on: 12-12-2010 04:42 AM
 noy be today story, the one  OBJ thief unoy don recover the money? what of his dauther why she noy dey jail. EFCC CHAIRMAN OR CHAIRWOMAN wetin dem call u self, u noy no ur work at all. no passed ministers have been brought to justice, we know the untouchable in niger, bring IBB to justice. u cant fool us. even the said woman is not injail, she is in 5 star hospital. america movie.
136  Forum / The Buzz Central / Re: Photos of Timaya and Empress Njamah on: 12-12-2010 01:48 AM
      TIMAYA NA WA 4U, U DON FORGET HOW U START? OR U WON TURN 2FACE NA?
137  Forum / The Buzz Central / Re: MAMA Africa 2010 Full Winners List MTV Awards on: 12-12-2010 01:41 AM
   2baba more grace to ur ebo,
Pages:
1 ... 4 5 6 [7]