Onyiima, i no know who confuse pass, u or jonathan.
Dem build power stations yet light no dey
Agriculture don improve yet we still dey import rice and beans
Dem increase minimum wage for paper yet dem no allocate the money to states to disburse am
Railway don dey work... For which state and by the wey u don enter am?
Dem dey build new university yet lectures go strike for almost a year for lack of funding for the old ones
Dem create employment... Go ask how many people dem retrench after im sell Nepa to Ghost buyers
2013 and 2014 no cue... Ask people for Abuja and North weda dem see fuel buy easily
Free and fair elections. Im be like say na cotonou u dey when dem dey take soja and Dss dey harass APC politicians for Ekiti
Airport wear new look.. When last u enter plane? Port Harcourt International Airport na Canopy be arrival and Departure hall
Im build schu for alumajiri work im no creat wait for dem
Naija youth jobless sotey Yahoo pay pass bank work
Naira don weak sotey dodo strong pass am
and u sidon there dey promote PDP propanganda
Yéyé dey smell
U can not stop importation in totality. This is where trade & batter come in. U export ur own goods to other countries & also import theirs. That is life, if u have not entered d train or even seen it ask those why have & who is ready to speak the truth. U are good in finding faults u don't see d good side of some else. It is people like u who will get there will not be able to move adime .