Show Posts
|
Pages: |
402
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / Re: I GO SPEAK MY MIND |
on: 3-11-2008 10:20 AM
| grin_genius4lif and rezimero, wetin una two dey drag sef,any opportunity una go just dey DIS unaself abi e get the babe wey una dey drag. Abeg let the house know o becos i no want wetin happen to 2pac and Biggy come repeat imself 4 naija o .GBAM | | |
404
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / FEET IN HEAVEN |
on: 1-11-2008 08:38 PM
| A teacher asked " what part of the body goes to heaven first"? a boy replies FEET. why the teacher asked surprised, the boy answered it is becos every nite i see my mum with her feet in the air screaming God i am coming | | |
406
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / FOR MARRIAGE NA WHO DEY HAPPY PASS? |
on: 1-11-2008 08:25 PM
| I wan ask one question, During marriage ceremony na who dey happy pass? na the man or the woman Na so i go one marriage for surulere, as the muscians dey sing that popular wedding song"its ur wedding day". come see where the woman wey marry dey rock, she dance eh come even benddown join , but when i look d man o boy no be small tin o, im just dey try to dance small small but im mind no dey for the music o e dey think of the expenses wey e go settle later and at the same time e dey use eye dey count how much people dey spray. | | |
407
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / ABEG WHO GET ERASER |
on: 1-11-2008 05:49 PM
| One day wey i go write JAMB i no too jack sha so when time for english reach i just decide to spy luckily one fine babe just siddon near me she just dey shade dey go without looking up na im i say okpe o na God carry me come siddon near this chic. The girl dey number 79 me dey number 62, i just dey follow am shade dey go. Na im the girl raise head come look me come see wetin i dey do na im she provoke some halla say "WHAT IT IS, WHY IS U SPYING ME. PLEASE DONT LOOK ME BOOK O! as i hear that english na im i halla for the hall WHO GET ERASER ABEG | | |
410
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / Re: Two Kolo guys |
on: 1-11-2008 05:30 PM
| rezimero and orezo abeg make una take am easy for grin_genuis4lif body, una wan kill the poor boy no go let hypertension catch person abi na high blood pressure make una sorry for am biko, ejo! | | |
411
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / SOME PASTORS SEF |
on: 1-11-2008 04:58 PM
| Some of our pastors during preaching, u go hear them dey preach say repent the kingdom of God is at hand jesus can come anytime, he can even come this very hour so u have to repent now but at the end of the preaching, the same pastor go come say everybody donate for our church building project that will be executed in 10 YEARS from now Na im one warri boy say ah ah shey u say Jesus fit come this minute, why u come dey ask us say make we give for sometin wey we wan use TEN years from now e be like say u no believe say jesus dey come again o MY FELLOW NAIJA PALS HOW UNA SEE THIS MATTER | | |
417
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / Re: 3 KICK RULE |
on: 30-10-2008 10:16 PM
| your supposed joke is too long and dry,try harder next time. anyway i like ur courage as u see say other people dey make person laugh u sef wan join abi? | | |
418
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / I GO SPEAK MY MIND |
on: 30-10-2008 04:08 PM
| Our naija guyz no dey try. Most guyz no like themselves. You go see where guy dey ask im fellow guy for 10 card my guy go dey give story! But make one chic come take that thing wey dem call Bosom rob my guy, money must come out of im pocket.
I remember when i dey come from lagos for inside Edegbe, one guy mistakenly rest head for anoda boy body due to sleep: see where my guy dey halla but to say na babe try am my guy 4 just dey smile like mumu
na im make girls dey mess anyhow 4 guyz present, the guy go as the girl what perfume are u wearing | | |
419
|
Forum / FunnyHub (Jokes + Comedy) / Re: Daddy Daddy |
on: 30-10-2008 03:25 PM
| OMO SEXY E BE LIKE SAY U GO LIKE phyuk WELL WELL O BECOS ANY OF UR JOKE NA ABOUT phyuk, IF U KNOW SAY U NEED GUY WITH LONG DICK NO HESISTATE TO CALL MY NUMBER 08037197265 | | | |