Bros!, i pitty u and ur Mrs. Na de bad thins wey we Africans do Oyibo pple na em dem de quick de talk come out say make everybody hear-am!, but all de Nyama-nyama thins wey dey don de do us starting from Adam na Eve, dem no de talk-am come out!. Dem de deceive our Mumu leaders say make dem de THIEF our money de carry-am come for oversea nobody go hear-am!. Dem de exploit our ecconomy and de use de money in building deir land make em de compette wit Paradise but dey no de talk all dez ones come out!. Dem de exploit us, thief our Gold, Diamonds, Silvers, Cruid oil, Petroliums,Timbers etc but why de no de considers all dez evils dem de do us?. Dem de encourage us say make we de fight and kill ourselves so dem go see chance sale deir Guns and Armonitions but dey no de talk-am come out!. I de see my bros dem, dis 1 go say na Yeruba and de other go say na Hausa and de other go say na Igbo man na dem be THIEF wey de spoil Naija name!, sorry my bros dem!....as una dey devided within una-selves, dat's why we neva achieve any good thins dem as a nation, devitions among ourselves dat's why Oyibo pple de see easy chances to enter us like fools!.
,
Bro tell dem jor