That Church !!!!!! I make mistake attend that Church for about 3 yrs, wetin I see my mouth no fit talk, any young man or woman when say na Christ embassy him or she wan attend I wish am good luck. I run like Usen Bolt and I have never stopped thanking God for that decision, now I dey worship for redeemed but I still dey watcful because if you never fall victim of brainwashing you no go know wetin I dey talk. 80% of christians are just serving the pastors and are being brain washed big time, These Pastors are living life to the fullest dem no even know wetin to do with money yet most members are just struggling ang giving almost all to the pastors without planning for the rainy day. The girls are worst off, thay are at the mercy of the pastors, some cannot even marry because they seek pastors permission and the man says no I do not approve of this man albeit with a selfish motive.I no fit talk, what about fake miracle ----- A man who was blind from birth purporttedly healed and asked to identify colours where e sabi differentiate colours when he was blind from birth? Finance convention nko with Apostle gbenga Igbafe? Pastors birthday nko? then anyday Pastor no dey around we go gather dey him preaching for TV like small children of dem days dey halla wo wo wo wo, yeho yeho like say na the man author the bible. this talk too many i no fir talk am finish----I forget what of blasting of babes by the jerry curl hair fine boy pastors. O boy just get money enter there you go do wetin you like and Pastor go dey honour you.
Bro, tell them. Blind followers. But u dey funny sha." a man who was blind from birth correctly named all the colours after his healing". what about living faith church aka winners chapel?