how much him wan give the woman wey him dey video-tell the whole world, highest 1k, all the money wey hard working keke, okada and motor drivers dey give police everyday nko, watin dem wan call that one sha na extortion or na daily offering abeg make una leave the immigration woman alone, na her work chop she dey, na where man dey hustle man dey chop, no be her side corruption start and no be there e end...