Akintoye: My guy, How far?
Emeka: Wetin dey happen?
Akintoye: Why you just dey call me now?
Emeka: You buy me credit?
Akintoye: Dis wan wey you call so, you wan show?
Wale: Where u dey?
Dele: You sabi Pius place?
Wale: Make we block der?
Dele: Before nko? Abi u wan make we block for anoda place?
Emeka: You get pepper?
Dele: Wetin you wan take money do?
Emeka: We no suppose drink?
Dele: Na me born you?
Emeka: No be u be my chairman?
Dele: Abi craze don log on to u? Na my pay u go dey use maintain?
Emeka: Before nko?
Dele: U serious abi you dey play?
Emeka: Bros, wetin u tink?
Dele: So, u no really hold change eh? And u wan drink? U no dey shame?
Emeka: Bros, which ones na ? Na change for beer come dey cause dis kind yarn?
Dele: Before nko?
"Ol'boy, who write this kind thing?" I asked the person who sent this to me. He replied. "You no go just enjoy the joke ? How I wan know ?" =)) =)) =)).....Gd A.M 2 U̶̲̥̅̊
Posted: at | |