Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship.
Then Airtel go com follow sey, recharge #100 an win benin republic.
Glo, go jus kuku say recharge 500 and win Nigeria bcos there colour na Green
Na only for Nigeria you go see fish inside "MEATPIE"
Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM
because we no even trust ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey sey: Win a brand new GENERATOR
if you pay your light bill (wat a piti)
Na only for Nigeria people dey horn for traffic light make e quick change frum Red to Green

Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff, Ogogoro and beer.
Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me.
NAIJA 4 LYFE...!!!!!!
TGIF.....
Posted: at | |