Warri boys letter to President Jonathan on ASUU strike. Hilarious!!

Date: 06-10-2013 6:44 pm (10 years ago) | Author: sunday Kayode
[1] 2 3 4
- at 6-10-2013 06:44 PM (10 years ago)
(m)
Oga Presido,

First of all I hail ooo! I no say u no dey cary last. You be confirm warri pikin. But ur middle name Ebele means mercy and make u pity ur children settle their lecturers naa! The matter neva tire u? Suppose say ur pikin wey u born for belle follow us dey house, Sheeh you for never answer our we lecturers them? Una say make we bone kidnapping, militant things and all the bad bad things go enter school, now now na una com dey f**k up. All the things wey them lecturers don teash us for klass we don forget am finish. Last last, na una go still call us “half-baked”, “half-roasted”, abi na “half-fried”. Na una sabi.

Them talk say person no fit run pass him shadow.
We go dey lasgidi dey for you. Na ur time be dis use am well, but we go catch you for 2015. U don forget say youths na we dey vote pass. Na we too dey snatch ballot box, dey do rally and som kain kukere things them wey them dey take win election. U go still nid our help. That time too we go go strike. Shebi u sabi waka for bare feet, u go carry ur leg do ur rally. No thugs for u. We no go snatch ballot make you for win. If any maga try am we go fall am.

So Oga Jona, na ur opportunity be dis ooo. Make u code this stubborn ASUU make dem cary their wahala goback. We no say na rush them go rush us we no send. All join. Na who get leg dey pass exam no be who read. Na still who get leg dey get beta work. Na Naija we dey. So make u do something because our mate dem for private university don graj finish. We don tire to dey beef them. If u no shake bodi fast make u no forget say university of militancy still dey admit. Dey neva release 2nd batch ooo!

May u grit maale Patience for we, thank baba God say she and gran papa Soyinka don settle that their quarrel, 2 agbayas, plus all those bad belle advisers wey u get. God pass them! Bros Amaechi still dey Niger-delta here, the guy don tire for ur mata. We dey grit u for am too. We go stop for here. E go be na. Naija! student for life!
Na ur waffi boy.

http://www.tundeola.com/2013/10/warri-boys-letter-to-president-jonathan.html

Posted: at 6-10-2013 06:44 PM (10 years ago) | Upcoming
- oyeleru at 6-10-2013 07:05 PM (10 years ago)
(f)
Warri no dey carry last patapata na draw...
Posted: at 6-10-2013 07:05 PM (10 years ago) | Newbie
Reply
- moniconyez at 6-10-2013 07:16 PM (10 years ago)
(m)
NNA TUUUUUUUUUUUUUUUUUU
Posted: at 6-10-2013 07:16 PM (10 years ago) | Hero
Reply
- Jbsexy at 6-10-2013 08:59 PM (10 years ago)
(m)
 Grin Cheesy
Posted: at 6-10-2013 08:59 PM (10 years ago) | Newbie
Reply
- 2bify at 6-10-2013 09:39 PM (10 years ago)
(m)
BABA TUUUUUUUUUUUUUUUUUU
Posted: at 6-10-2013 09:39 PM (10 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Orojoe at 6-10-2013 10:13 PM (10 years ago)
(f)
 Grin Grin Grin
Posted: at 6-10-2013 10:13 PM (10 years ago) | Upcoming
Reply
- jossy4reall at 7-10-2013 06:20 AM (10 years ago)
(m)
funny but na the truth dem yarn

Posted: at 7-10-2013 06:20 AM (10 years ago) | Hero
Reply
- francischi at 7-10-2013 01:44 PM (10 years ago)
(m)
serious

Posted: at 7-10-2013 01:44 PM (10 years ago) | Hero
Reply
- kennynaija at 7-10-2013 03:50 PM (10 years ago)
(m)
SURE GUYS Grin Grin Grin

Posted: at 7-10-2013 03:50 PM (10 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Shegzan at 7-10-2013 09:19 PM (10 years ago)
(m)
Kk#

Posted: at 7-10-2013 09:19 PM (10 years ago) | Gistmaniac
Reply
- toibeli at 8-10-2013 02:29 AM (10 years ago)
(m)
 Grin Grin Grin
Posted: at 8-10-2013 02:29 AM (10 years ago) | Gistmaniac
Reply
- IDOKOO at 8-10-2013 03:14 AM (10 years ago)
(m)
Malam abeg, come teach me how i go take conect d RED WIRE make dis knock BLOW.
Posted: at 8-10-2013 03:14 AM (10 years ago) | Upcoming
Reply
- IDOKOO at 8-10-2013 03:15 AM (10 years ago)
(m)
Malam abeg, come teach me how i go take conect d RED WIRE make dis knock out BLOW.
Posted: at 8-10-2013 03:15 AM (10 years ago) | Upcoming
Reply
- katdeluna2 at 8-10-2013 04:50 AM (10 years ago)
(f)
True word. Dat Jona man na big mumu he be o
Posted: at 8-10-2013 04:50 AM (10 years ago) | Upcoming
Reply
- Solidstonez at 8-10-2013 06:22 AM (10 years ago)
(f)
Una try well well

Posted: at 8-10-2013 06:22 AM (10 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Dencybaby at 8-10-2013 06:41 AM (10 years ago)
(f)
oga presido u don hearam nah
Posted: at 8-10-2013 06:41 AM (10 years ago) | Newbie
Reply
- dickman2 at 8-10-2013 06:44 AM (10 years ago)
(m)
na lie..no warri boys send no letter to no body..poster u dey mad for using warri as your headline..useless boy..na your brother write am ..
Posted: at 8-10-2013 06:44 AM (10 years ago) | Addicted Hero
Reply
- vickbest at 8-10-2013 06:45 AM (10 years ago)
(f)
oga presido need to see this abeg
Posted: at 8-10-2013 06:45 AM (10 years ago) | Newbie
Reply
- Jiggaman6 at 8-10-2013 06:46 AM (10 years ago)
(m)
Shoooo....militancy university stil dey admit
Posted: at 8-10-2013 06:46 AM (10 years ago) | Newbie
Reply
- onyeozo at 8-10-2013 06:46 AM (10 years ago)
(m)
Ok naa
Posted: at 8-10-2013 06:46 AM (10 years ago) | Gistmaniac
Reply
[1] 2 3 4