Nico gravity disses timaya (song titled i wan finish timaya )

Date: 01-10-2009 5:01 am (15 years ago) | Author: bolaji baoku
- at 1-10-2009 05:01 AM (15 years ago)
(m)
free download here http://d323fef0.linkbucks.com
http://d323fef0.linkbucks.com



When I heard the song the first time, I was like "O boy wetin Timaya do this man now". But after listening over again, I realized what he was saying. It goes like this


I wan finish Timaya
I wan pieces the maga
I wan enter the small boy wey tell everybody say im be egberi papa
The thing wey dey vex me be say nowadays children dem no dey get respect
If you give them microphone make them sing wetin dem sabi na to dey praise themselves
During our time, I say no be like this
Musician dey blow, musician dey fade
If you never blow, my brother wait for your turn
If you don blow, make you no use am dey pose
No use an dey brag, no use am dey show off o

See Timaya, e too dey pose
See Timaya, e too dey brag
Anywhere he enter na so e go dey pose
Scatter im face, carry shoulder up
He buy motor, he go take am sing
He f**k t*t*, he go take am sing
He smoke I**o, he go take am sing
He rent flat, he go take am sing

Me I take am say na lack of education
He no sabi handle fame and fortune
He no ever believe say he go get money
When small money come, e come enter im head
Come scatter im brain, come make am dey feel like egbe
Original egbe the papa

Chorus
I wan finish Timaya
I wan pieces the maga
I wan scatter the mugu
I wan enter the small boy wey tell every body say im be egberi papa

Well right now today today Naija dey gbadun your style
Thank God for your life, I happy say you dey shine
But I hope say no be only motor you just dey buy
I hope you dey put some money for bank
Because I hear you dey talk of Camry 2.2
And I hear you dey talk about Toyota Spider
Small thing you for tell us say you buy helicopter

See, I get small advice eh, I hope say you dey plan for your future well
I get one secret to tell you, no musician go reign forever
I get one koko to yarn you, one day Naija go bone your face o
Remember say na only one style you dey use
Remember say na *** dem dey use for your voice
One day your juju go clear from people eyes
That time if you sing, e go be dem like say na noise

Remember say you never reign reach Kimono
Remember say you never reign reach Baba Fryo
Remember say you never reign reach Daddy Showkey
Remember say you never reign reach Daniel Wilson
Remember say you never reign reach Blackky
Remember say you never reign reach Danfo Drivers
Remember say you never reign reach Shina Peters
Remember say you never reign reach Tuface Idibia

All these people dem reign, dem let person hear word
E don reach your turn, everyday na to dey pose
You don forget say to reign na luck, no be sabi and no be by work
So my paddy make you no come here dey start to dey pamurogo, carry shoulder up just like a tolotolo
Blah blah blah,

What do you think about it?

Posted: at 1-10-2009 05:01 AM (15 years ago) | Newbie
- princenas at 1-10-2009 02:41 PM (15 years ago)
(m)
i need Yori Yori lyrics by Brakets. Cameroon di die for this song.
Posted: at 1-10-2009 02:41 PM (15 years ago) | Newbie
Reply
- kouga at 4-10-2009 01:20 PM (15 years ago)
(m)
o boy dis guy done finish timaya, see enough word. but he yan di koko, na d koko bi dis abeeg!!!.
Posted: at 4-10-2009 01:20 PM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- lamsey at 9-10-2009 09:05 PM (15 years ago)
(m)
d guy jagajaga timaya finish............but d truth im dey yan........
Posted: at 9-10-2009 09:05 PM (15 years ago) | Newbie
Reply
- Raybigboy at 27-10-2009 12:33 PM (15 years ago)
(m)
Men, dis guy too much o! see lyrics na...en just fall timaya hand...i sure sey timaya go cool down now..
Posted: at 27-10-2009 12:33 PM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- neossha at 29-10-2009 10:51 PM (15 years ago)
(f)
d truth is bitter.....lolz
Posted: at 29-10-2009 10:51 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- segxi at 30-10-2009 03:52 PM (15 years ago)
(m)
thats reality
Posted: at 30-10-2009 03:52 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- neossha at 30-10-2009 04:59 PM (15 years ago)
(f)
Quote from: neossha on 29-10-2009 10:51 PM
d truth is bitter.....lolz
nd it has 2 be said.
Posted: at 30-10-2009 04:59 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- next2me at 12-11-2009 04:12 PM (15 years ago)
(m)
Remember faze talk say "IF I BUY AEROPLANE OHH NA WETIN COME DEY MAKE YOU COMPLAIN OHHH,ME AND YOU WE NO BE THESAME OHHH"..............

If timaya buy 2.2 tell me na wetin con dey make the guy complain? Tu face wey they by all sort of expensive cars nkor? i wonder why timaya own con dey pain am for body... Old man wey won use small boy climb the lader of fame, but e don forget say haters no dey succeed....
Posted: at 12-11-2009 04:12 PM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- Ortopazz at 22-06-2011 02:22 AM (13 years ago)
(m)
TIMAYA NO CHOP IM LEVEL O
Posted: at 22-06-2011 02:22 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- beatrice22 at 22-06-2011 11:27 AM (13 years ago)
(f)
y do u hate timaya so much,,,,, go and buy ur own cars ,, jealossssssssssssssssssy
Posted: at 22-06-2011 11:27 AM (13 years ago) | Upcoming
Reply
- ahmedfifa at 31-08-2011 02:05 PM (13 years ago)
(m)
Timaya sorry wooohhhhhhhhh let there is a peace plszzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzzz
Posted: at 31-08-2011 02:05 PM (13 years ago) | Newbie
Reply
- naucheya at 23-11-2011 02:12 AM (13 years ago)
(m)
ple timaya stop they bose and they pose i can see you want to go and kill nico gravity if you try it god we not be happy with you ok and pupli we stop buy you music and you we fall so go and make paces with you big brother ok . nico gravity  stop sing that type of music ples is not good i love you nico gravit and  timaya good buy
Posted: at 23-11-2011 02:12 AM (13 years ago) | Newbie
Reply
- PoliticxGuru at 20-08-2015 11:27 PM (9 years ago)
(m)
U try
Posted: at 20-08-2015 11:27 PM (9 years ago) | Hero
Reply

Featured Discussions