Why the thing dey pain u like this na
First of all, (mandatory go down low). Secondly, unlike you wey dey spend your time on naijapals 24/7, me, i get life. I no dey like you, wey get time to reply every single person wey comment for an article, everyday for 1 exhausting month with your excruciatingly unfunny, dull and stupid, irrelevant, comments and replies. If you go reply person comment wey no concern or get anything to do with you, at least have the courtesy to make am funny.
Furthermore, I no even run, I no even want win, I just dey read wetin dey happen, if I like, I comment, if not, I pass. When e go pain me nah if I run the proverbial race then become runner up to person like you.. ehen!! Wetin in fact dey pain me pass nah the way dem dey treat POLITICXGURU guy. Just dey ban the guy anytime him dey lead. #JUSTICEFORPOLITICXGURU
More so, wetin be 15k? nah like 75 dollars, carry am enter shoprite, nah only indomie you fit carry comot.
My comment means the ''drumroll'' dey redundant for this situation because we already know who the winners dem be. Try to understand people comments before you reply, lest you make yourself sound like a buffoon.
*Rant over, carry on fams*
Posted: at 2-10-2015 11:58 AM (9 years ago) | Upcoming |
|