This particular game no dey my head at all. Na on d 15 of May wey I start to day comment meaningful comments just dey observe as things dey go. Everybody wey post comments, dem dey subtract from am. Mostly repetition of words no dey count.
All of us dey,,,,, yawa_don_gas - Eazyatumeyi - Novic - Oworen25 - CHRISETTE - dickieponga - kachasi - botlex - gogoman - AmazingMarie - leodavinci - kabukabu - Mykie010 until these two "'mia4321 and raynebee'" from nowhere waka enter here. hmmmm, nawa oooooo ,,, sowie...,, as in all dier grammar no dey complete d highest, 3 letter words. BT d tin wey dey funny pass even with their so many repetitions yet naijapals dey score dem 10/10. Since dem come, dem never get minus 1. E.g, yesterday mia post count na 399post count/399comments n d oda lady behind am 206/206. Na him me vex, as to say more than half of d topics I never comments make I do like dem no wetin dey happen. I start from d beginning of May to dis day totaling 683 comments, una no wetin dem dash me? Them gi mi 158/683 e no even reach half of wetin I never comments since dis mth BT gi dem,,, mia- 128/128 d 2nd one,,,, 153/153. E be as get BT I still dey observe shaa...
Posted: at | |