Police 'Blame' Prostitution For 'Port Harcourt Serial Killer' - BBC Pidgin

Date: 14-09-2019 1:32 pm (4 years ago) | Author: Mister Jay Wonder
- at 14-09-2019 01:32 PM (4 years ago)
(m)

Police for Port Harcourt, Rivers state say make women no go into prostitution so dem no go fall victim of di kain killing wey dey happun for di area.

Last month, police confam di killing of three young women for hotels for different parts of di city and say two of dem die by strangulation wit white cloth around dia neck.

Wen im dey tok to some women wey do I-no-go-gree waka go police headquarters inside di state, Chuks Enwonwu, wey be number two police oga for Rivers say dem don get reports of di "serial killer."

Though im no tok weda police don confam say true-true dis pesin na serial killer, oga Enwonwu come advice di women to advice dia fellow women.

"In as much as values for society dey go back, make una go back to try to educate dem and discourage dem make dem no do prostitution, because na dia dem fit fall victim to dis kain crime," im tok.

But Soibi Ibibo Jack wey organise di protest waka tell BBC Pidgin say dia concern be say police dey describe all di women wey don die say dem be prostitutes, say dat wan no be true. She say "even if dem be sex workers, dia lives mata, dem be human beings."

Oga Enwonwu also tell di women say police don make some arrests concerning dis mata and say investigation still dey go on.

Enwonwu add say dem don get meetings wit management of hotels for di state on ways dem go do proper documentation of evri pesin wey come lodge for dia hotel and put cameras for place wey go capture pipo well so dem know who come and go from di hotels.


Posted: at 14-09-2019 01:32 PM (4 years ago) | Addicted Hero
- Kormeijama at 14-09-2019 01:52 PM (4 years ago)
(m)
Where are the  required CCTV s that all such places  must maintain for  occurrences .
Posted: at 14-09-2019 01:52 PM (4 years ago) | Gistmaniac
Reply
- tonyigho at 15-09-2019 08:37 AM (4 years ago)
(m)
Instead  the police will talk of installing cctv in all hotel's,  they are talking  different thing, have they not see a girl.who is not a prostitute but was killed  also, think of the security way of solving the problem  than talking  rubbish.
Posted: at 15-09-2019 08:37 AM (4 years ago) | Gistmaniac
Reply

fire TRENDING GISTS fire

TODAY'S TOP
  1. 74Yr Old Woman Robs Bank At Gunpoint After Losing Her Life Savings To Online Scammers

  2. We Find Love in Unexpected Places – Bimbo Ademoye Writes As She Shares Loved-up Photo With Timi

  3. Ex-runs Girl Lands Herself In Trouble After Finding Out Her Former Client Is Her Brother-in-Law

  4. How Abusive Nigerian Man, Beat Wife To Death Months After Relocating To The UK

  5. Actress, Stella Udeze Reveals Why Actresses Have Unhappy Relationships

  6. Late Mohbad’s Toxicology Result Ready As Pathologist Begins Evaluation

  7. Interior Minister, Tunji-Ojo To Relocate Suleja Correctional Centres To Avoid Inmate Escape

  8. 'Avoid Panic Buying, Petrol Prices Not Changing' — NNPC To Nigerians


THIS WEEK
  1. Abia Police Parade Suspected Criminals, Including ABSU Student Involved In Fatal Shooting

  2. 'Brand Ambassador', Phyna Calls Out Pepsi For Supplying Her Expired Drinks

  3. Lady Who Was Dragged For Wearing a Racy 'Asoebi' Outfit to a Wedding Reception Breaks Silence

  4. Lady Who Left The UK With Her Family to Return Home to Nigeria Reveals Why She Did So

  5. UNIPORT Lecturer Caught on Camera Pants Down, S3xually Harassing a Female Student in His Office

  6. VID: Peter Obi Replies Critics Asking Him Why He Didn't Build a School in Anambra as a Governor

  7. Nollywood Actress Toyin Abraham Extends Olive Branch To Funke Akindele,Calls For Industry Unity

  8. "Emefiele, Kanu Arrested Arbitrarily As Pre-Trial Detention Persists In Nigeria" – US Govt Says

  9. Watch Touching Video Of Lady Surprising Boyfriend Who’s An Okada Rider

  10. Yoruba Nation: Akintoye, Sunday Igboho Write Open Letter To Tinubu, Seek Exit From Nigeria


TOP MEMBERS: