From naijapals headquaters

Date: 22-03-2011 1:21 am (13 years ago) | Author: Ugochukwu Terry Ofoegbu
[1] 2 3 4 ... 8
- at 22-03-2011 01:21 AM (13 years ago)
(m)
Abeg make una dey try post reasonable things here.na beg i dey beg una cos wetin dey hapun 4 Np again dey disgust.person go wake up,carry brush brush mouth,eat breakfast and go open him computer then him mind,eyes,hands ,brain go allow am post nonsense yoke.u go see pple wey go post ''Terry is coming'' and another idiot go post ''i wan go eat''(wetin concern me if u wan go eat?)another legalised idiot go post ''Deffney get white body''(and so?)then another certified idiot go post ''Solid is fighting over a girl''.then our madam gucci go post her lengthy article.some go post one crap thing all in the name of getting one useless rank.abeg if u want get rank,no need of posting senseless posts,just dey comment for anoda pple joke.i knw say i no dey post joke,but abeg make una dey try dey post reasonable posts.una dey pursue customers here and make una try to put network on pple's face.abeg if u no get anything reasonable to post,just shut ur computer down then carry ur bible read.if u must post trash,abeg ask them to create forum 4 u and ur senseless posts.

If u vex,go hug transformer or u fit take dry pepper do eye shadow


Posted: at 22-03-2011 01:21 AM (13 years ago) | Hero
- Deffney at 22-03-2011 02:43 AM (13 years ago)
(f)
''Deffney get white body''(and so?)


hehehehehehehehe..Terry on d making at this early Tuesday....

beta shutdown ur computer and get ur bible and read... Wink Wink Wink Wink Wink Wink

Posted: at 22-03-2011 02:43 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Abolore05 at 22-03-2011 04:14 AM (13 years ago)
(f)
na true u talk jare
abeg the thing tire person for here
instead of putting on ur computer
to read joke
na story wey no make sense u go dey see!
WE NEED FILTER HERE!!!!!!!!!!
Posted: at 22-03-2011 04:14 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Deffney at 22-03-2011 04:21 AM (13 years ago)
(f)
filterizzzeee jokes forum na!!!!

make all laugh, smile and happy!

Posted: at 22-03-2011 04:21 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Abolore05 at 22-03-2011 04:54 AM (13 years ago)
(f)
 Grin Wink
Posted: at 22-03-2011 04:54 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Deffney at 22-03-2011 05:01 AM (13 years ago)
(f)
 Grin Grin Grin Grin Grin Grin

Posted: at 22-03-2011 05:01 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- terryworld at 22-03-2011 06:11 AM (13 years ago)
(m)
una dey surprise? But na d fact be dat!
Something dats meant not to be taken serious,some half baked idiot go use am do their pillow even when u r playing with them.
Person go post joke and pple go write 'pb4' for him joke and dat idiot go vex,why u dey vex 4?

See anybody wey no go fit withstand pb4 shock 4 him post,him no qualify to be here or if sb taunt u or ur tribe and u took personal,omo ur own don end cos na vex u go dey vex all ur life.yabbing is part of d joke and sometimes what pple comment makes a joke to be sweeter.
If u post joke and nobody write 'pb4' then ur joke no go sell cos dat was what i experience when i was new here until sb told me d rules.pple do tease me all d time.
Thanks 4 understanding but if u no understand then carry vex do ur food!

Posted: at 22-03-2011 06:11 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- Deffney at 22-03-2011 06:16 AM (13 years ago)
(f)
 Grin Grin Grin Grin Grin


Posted: at 22-03-2011 06:16 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Abolore05 at 22-03-2011 07:07 AM (13 years ago)
(f)
true talk again Terry!
na dis make realise say
all wetin u dey talk since
NA PB4
i don post am before!
u b copy copy
 Grin Grin Grin Grin
Posted: at 22-03-2011 07:07 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Omilim at 22-03-2011 08:16 AM (13 years ago)
(f)
i get you..you right terryworld Smiley
Posted: at 22-03-2011 08:16 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- bodeniyi at 22-03-2011 08:32 AM (13 years ago)
(m)
terry dey vex... na my joke be that
Posted: at 22-03-2011 08:32 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- terryworld at 22-03-2011 08:46 AM (13 years ago)
(m)
esp newbeans

Posted: at 22-03-2011 08:46 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- terryworld at 22-03-2011 10:25 AM (13 years ago)
(m)
of course yes na pb4 but u dey craze 4 belle

Posted: at 22-03-2011 10:25 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- sandra-marbel at 22-03-2011 10:52 AM (13 years ago)
(f)
terry.. i think u'r making a good point... pls its joke forum and not politics or the kind of rubbish gucci posts here for us... its horrible.  i wish all pals in joke forum will understand that everything is all about joke..we dont see alot of people anymore.its bad :'( :'( :'( :'( i want to smile again,,infact i want to laugh.
Posted: at 22-03-2011 10:52 AM (13 years ago) | Upcoming
Reply
- chicanorose at 22-03-2011 10:55 AM (13 years ago)
(f)
oga terry i hail oooooooooooo
 Grin Grin Grin Grin Grin Grin

Posted: at 22-03-2011 10:55 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- at 22-03-2011 11:02 AM (13 years ago)
see all of them complete for the house.
kings and queens from Aproko Kingdom,
Amobo ,Aproko una don carry new one come?
new yeye in the house Grin Grin
Posted: at 22-03-2011 11:02 AM (13 years ago) |
Reply
- sandra-marbel at 22-03-2011 11:04 AM (13 years ago)
(f)
emejuru... define yeye.
Posted: at 22-03-2011 11:04 AM (13 years ago) | Upcoming
Reply
- at 22-03-2011 11:06 AM (13 years ago)
or you just enter house,
you don join your Aproko gang ,
weldon ooo Grin
Posted: at 22-03-2011 11:06 AM (13 years ago) |
Reply
- chicanorose at 22-03-2011 11:09 AM (13 years ago)
(f)
Quote from: emejuru on 22-03-2011 11:02 AM
see all of them complete for the house.
kings and queens from Aproko Kingdom,
Amobo ,Aproko una don carry new one come?
new yeye in the house Grin Grin

tatafo like you
 Shocked Shocked Shocked Shocked

Posted: at 22-03-2011 11:09 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- at 22-03-2011 11:10 AM (13 years ago)
Quote from: sandra-marbel on 22-03-2011 11:04 AM
emejuru... define yeye.

yeye na when you look like you,
Aproko abeg enter una house Grin Grin
Posted: at 22-03-2011 11:10 AM (13 years ago) |
Reply
[1] 2 3 4 ... 8