E get this guy , the guy na naija guy wey dey live for panya alias spain. Nne see me see trouble ooo

na so hin come dey promise me paradise he go buy me house,he go take me go spain ,he go dey load my account every month, i just need say yes. hmmmmmmmmmm..... NAWA,anyways sha the guy con dey pesturize my life ooo, hin gojust dey park hin car everyday for front of my house dey wait for me , Na so i just say one day make i settle am before my neighbours give me name , today nah limo to morrow nah homa, this girl eeehn

, na hin i gree go on a date with the bobo just to hear wetin hin gat say. na hin i order small thing , but i no chop anything cos hungry no catch me

, anyways after every , the guy say make i enter car , thank GOD say my school dey close to the restaurant na hini say i go waka go back cos i get lectures , hin come say no hin want make i no where hin dey live , i surprise ooo,i con saynext time, na hin the bobo vex say hingo collect the money for the food back

chineke

, na hin say abeg make hin tell me how much hin pay make i pay in hard currency

the guy come mellow , GOD no say i no get shi shi for hand , i just dey make shakara
anyways,my questions is guys just bcos agirl ordered and refused to eat would u go asfar as collecting your money back? and especiallly if she no follow u go house . ladies what will u do if a guy ask for his money for a date ?those cars you dey see ni NA "BORROW POSE"leave the guy waka abeg! em be poor guy if en chop your honeypot 2day 2morrow en go look 4 another victim. WISE UP LADIES