dream..(if u tink its pb4 abeg no open)

Date: 18-05-2012 2:28 pm (11 years ago) | Author: Tonia Ebije
[1] 2 3 4 ... 6
- at 18-05-2012 02:28 PM (11 years ago)
(f)
One day my papa call me, my
brother and my mama
together come tell us say if
we dream say them wan give
us something for dream make
we no collect, say na enemies
wan give us bad things.
He say if we dream that kind
dream make we tell am and
he go buy that thing wey
them wan give us for dream
for us.
Two days later my brother
sleep for night dey mention
RICE! RICE!! RICE!!!, ma papa
wake am say wetin dey
happen, he say them wan
give am rice for dream.
My papa give am N500 say
make he go chop rice.
When I see say the thing dey
work, the next day I start to
dey shout MR BIGGS!!! MR
BIGGS!!! for night.
Ma papa say wetin, I say
them wan gimme Mr Biggs for
dream.
My papa gimme N1000 make
I take chop Mr Biggs.
Na so I do wey I take buy my
phone.
But the one wey I do wey I
take spoil everything na for
one night wen I dey shout
RANGE ROVER!!! RANGE
ROVER!!!
Ma papa wake up say wetin.
I say them wan gimme RANGE
ROVER for dream.
Na hin my papa shout,
"Hope say u collect am?"
Na hin I say no.
"Will u get back to bed and
collect that thing STUPID
BOY!!!"

Posted: at 18-05-2012 02:28 PM (11 years ago) | Upcoming
- jossy4reall at 18-05-2012 05:25 PM (11 years ago)
(m)
its gud and not pb4..........but ar u a boy or a girl?

Posted: at 18-05-2012 05:25 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- chummyli at 18-05-2012 06:17 PM (11 years ago)
(f)
Na pb4 ooooo! Jossy u don de lie n de ask ehim gender so u go leave jox woo her abi?

Posted: at 18-05-2012 06:17 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- Thonya at 18-05-2012 07:03 PM (11 years ago)
(f)
lolzzzz,am F oo..i b new bie oo...jst acceptt any 1 i post
Posted: at 18-05-2012 07:03 PM (11 years ago) | Upcoming
Reply
- jossy4reall at 18-05-2012 07:22 PM (11 years ago)
(m)
Quote from: chummyli on 18-05-2012 06:17 PM
Na pb4 ooooo! Jossy u don de lie n de ask ehim gender so u go leave jox woo her abi?





chummyli I don dey warn u ooo......no take Joxcel play wit me........as 4 d poster...her profile dey talk female but d joke come dey talk male... datz why I dey ask.........but I don understand say na C&P

Posted: at 18-05-2012 07:22 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- zeigbo at 18-05-2012 07:28 PM (11 years ago)
(m)
Nice 1

Posted: at 18-05-2012 07:28 PM (11 years ago) | Addicted Hero
Reply
- ANELEEVEREST at 18-05-2012 07:37 PM (11 years ago)
(m)
9ice 1 but posted pb4
Posted: at 18-05-2012 07:37 PM (11 years ago) | Gistmaniac
Reply
- chummyli at 18-05-2012 08:32 PM (11 years ago)
(f)
Thonya welcome

Posted: at 18-05-2012 08:32 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- Thonya at 18-05-2012 08:53 PM (11 years ago)
(f)
tnx tnx tnx....am happy nw
Posted: at 18-05-2012 08:53 PM (11 years ago) | Upcoming
Reply
- jossy4reall at 18-05-2012 09:00 PM (11 years ago)
(m)
Quote from: Thonya on 18-05-2012 08:53 PM
tnx tnx tnx....am happy nw





so when I welcome u b4 b4.....u no happy huh

Posted: at 18-05-2012 09:00 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- zeigbo at 18-05-2012 09:02 PM (11 years ago)
(m)
Yes

Posted: at 18-05-2012 09:02 PM (11 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Thonya at 18-05-2012 09:03 PM (11 years ago)
(f)
u yab me b4 u welcome me na...ok take ur own 'tnx'
Posted: at 18-05-2012 09:03 PM (11 years ago) | Upcoming
Reply
- chummyli at 18-05-2012 09:04 PM (11 years ago)
(f)
Kikikiii jealousy

Posted: at 18-05-2012 09:04 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- jossy4reall at 18-05-2012 09:08 PM (11 years ago)
(m)
Quote from: Thonya on 18-05-2012 09:03 PM
u yab me b4 u welcome me na...ok take ur own 'tnx'






na lie.., and now u complain b4 u give me tnx...so I no nid am

Posted: at 18-05-2012 09:08 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- chummyli at 18-05-2012 09:10 PM (11 years ago)
(f)
Beta

Posted: at 18-05-2012 09:10 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- Thonya at 18-05-2012 09:11 PM (11 years ago)
(f)
ok oo,i don hear
Posted: at 18-05-2012 09:11 PM (11 years ago) | Upcoming
Reply
- jossy4reall at 18-05-2012 09:15 PM (11 years ago)
(m)
Quote from: chummyli on 18-05-2012 09:04 PM
Kikikiii jealousy





kokokooo.., poke nosing

Posted: at 18-05-2012 09:15 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- jossy4reall at 18-05-2012 09:19 PM (11 years ago)
(m)
Quote from: Thonya on 18-05-2012 09:11 PM
ok oo,i don hear



gud

Posted: at 18-05-2012 09:19 PM (11 years ago) | Hero
Reply
- Thonya at 18-05-2012 11:49 PM (11 years ago)
(f)
dis jossy e b lyk say u sabi find trouble
Posted: at 18-05-2012 11:49 PM (11 years ago) | Upcoming
Reply
- jeffrey4u at 19-05-2012 12:27 AM (11 years ago)
(m)
 Grin Grin Grin
Posted: at 19-05-2012 12:27 AM (11 years ago) | Gistmaniac
Reply
[1] 2 3 4 ... 6