I GO SPEAK MY MIND

Date: 30-10-2008 4:08 pm (15 years ago) | Author: Kelvin Junior
[1] 2
- at 30-10-2008 04:08 PM (15 years ago)
(m)
Our naija guyz no dey try. Most guyz no like themselves. You go see where guy dey ask im fellow guy for 10 card my guy go dey give story! But make one chic come take that thing wey dem call Bosom  rob my guy, money must come out of im pocket.

I remember when i dey come from lagos for inside Edegbe, one guy mistakenly rest head for anoda boy body due to sleep: see where my guy dey halla but to say na babe try am my guy 4 just dey smile like mumu

na im make girls dey mess anyhow 4 guyz present, the guy go as the girl what perfume are u wearing

Posted: at 30-10-2008 04:08 PM (15 years ago) | Upcoming
- grin_genius4lif at 30-10-2008 05:45 PM (15 years ago)
(m)
funny. reality.
Posted: at 30-10-2008 05:45 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- segxi at 30-10-2008 06:56 PM (15 years ago)
(m)
wetin u expect
Posted: at 30-10-2008 06:56 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rezimero at 30-10-2008 11:34 PM (15 years ago)
(m)
your own behaviour no bad pass wetin you just talk so?
Posted: at 30-10-2008 11:34 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- grin_genius4lif at 31-10-2008 09:58 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: rezimero on 30-10-2008 11:34 PM
your own behaviour no bad pass wetin you just talk so?
u enter him stomach?  Roll Eyes Roll Eyes
Posted: at 31-10-2008 09:58 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rezimero at 31-10-2008 11:16 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: grin_genius4lif on 31-10-2008 09:58 PM
Quote from: rezimero on 30-10-2008 11:34 PM
your own behaviour no bad pass wetin you just talk so?
u enter him stomach?  Roll Eyes Roll Eyes
go do wetin?
Posted: at 31-10-2008 11:16 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- grin_genius4lif at 1-11-2008 10:41 AM (15 years ago)
(m)
How u take know say him behaviour bad if u no enter him stomach? o boy e be like say something don misplace somewhere in ya head oh. i sory for you
Posted: at 1-11-2008 10:41 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- orezo at 1-11-2008 01:44 PM (15 years ago)
(m)
True story my broda... @poster
Posted: at 1-11-2008 01:44 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Emzycas at 1-11-2008 04:57 PM (15 years ago)
(m)
My broda, make i talk my mind too- u too dey guilty of the same offence cos u don do am b4. Tongue Tongue Tongue
Posted: at 1-11-2008 04:57 PM (15 years ago) | Newbie
Reply
- rezimero at 1-11-2008 11:03 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: grin_genius4lif on  1-11-2008 10:41 AM
How u take know say him behaviour bad if u no enter him stomach? o boy e be like say something don misplace somewhere in ya head oh. i sory for you
y u always dey follow me? u be my dog?
Posted: at 1-11-2008 11:03 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- grin_genius4lif at 2-11-2008 08:17 PM (15 years ago)
(m)
u for talk say make i no waka cos u be Julius Berger wey dey waka for road. anyway sha i no follow you again ohh. Leave me alone.
Posted: at 2-11-2008 08:17 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Jboy4shezo at 3-11-2008 10:20 AM (15 years ago)
(m)
grin_genius4lif and rezimero, wetin una two dey drag sef,any opportunity una go just dey DIS unaself abi e get the babe wey una dey drag. Abeg let the house know o becos i no want wetin happen to 2pac and Biggy come repeat imself 4 naija o .GBAM
Posted: at 3-11-2008 10:20 AM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- orezo at 3-11-2008 10:28 AM (15 years ago)
(m)
Na grin_genius dey look for wahala...

he too like trouble...
Posted: at 3-11-2008 10:28 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rezimero at 3-11-2008 11:16 AM (15 years ago)
(m)
Quote from: Jboy4shezo on  3-11-2008 10:20 AM
grin_genius4lif and rezimero, wetin una two dey drag sef,any opportunity una go just dey DIS unaself abi e get the babe wey una dey drag. Abeg let the house know o becos i no want wetin happen to 2pac and Biggy come repeat imself 4 naija o .GBAM
bros no be ame wey dem for dey carry gun dey waka na im we dey o. na naija we dey 2pac and biggy case no fit happen for here. anyway grin na my guy na to make the house dey lively na im we dey after. next time e be say na you we go face Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin
Posted: at 3-11-2008 11:16 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Jboy4shezo at 3-11-2008 09:26 PM (15 years ago)
(m)
no shaking
Posted: at 3-11-2008 09:26 PM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- grin_genius4lif at 3-11-2008 09:34 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: Jboy4shezo on  3-11-2008 09:26 PM
no shaking

Which bone u take wan fight . people dey yan for ground u too wan show. yeye man. Abi no be dat kind thing u want.
Posted: at 3-11-2008 09:34 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Jboy4shezo at 4-11-2008 10:02 PM (15 years ago)
(m)
grin i pity u o, u see person wey wan help u attack ur terroist u still dey get bad mouth abi u swallow pit-toilet
Posted: at 4-11-2008 10:02 PM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- queenrukky at 23-09-2011 03:09 PM (12 years ago)
(f)
 Cool
Posted: at 23-09-2011 03:09 PM (12 years ago) | Hero
Reply
- Ak33m at 23-09-2011 07:30 PM (12 years ago)
(m)
poster u get sista?
Posted: at 23-09-2011 07:30 PM (12 years ago) | Gistmaniac
Reply
- MegaOneplusone at 23-09-2011 09:00 PM (12 years ago)
(m)
If na 10 card, abeg if you get free ya guy but if na hand, no try am oo...i no dey romance with man Grin Grin
Posted: at 23-09-2011 09:00 PM (12 years ago) | Gistmaniac
Reply
[1] 2