Show Posts
Pages:
1 ... 9 10 11 [12] 13 14 15 ... 27
221  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Denrele Edun Reveals His Girlfriend at Last (Mayshau) on: 18-02-2015 09:40 PM
na lie. na fronting. we all know wetin Denrele be na
222  Forum / Politics / Re: GEJ Rules Out Investigation Of Audio On Ekiti Polls, Says It Was “Fabricated" on: 15-02-2015 04:23 PM
una see d kain person wey una say make we give anoda 4yrs. nothing dey ever wrong for im eyes. corruption don erode im common sense. since when im bcom forensic expert for audio recording
223  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Photo of Senator Obanikoro Working Out at The Gym on: 11-02-2015 05:17 PM
He suppose dey serve jail term instead of gym time
224  Forum / Politics / Re: “APC Offered Me Money To Join Their Party” - Afrocandy on: 11-02-2015 01:15 AM
after dem no pay am for the ojingba film wey she do, she don dey look for cheap publicity for her next ojingba movie
225  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Buhari Spoke For Only 57 Minutes In All His Campaign Rallies Across Nigeria on: 10-02-2015 08:59 PM
content quality is more important than bullshit quantity
226  Forum / Politics / Re: PHOTOS: At Last, Governor Raji Fashola Finally Collects His PVC on: 9-02-2015 01:01 PM
Baba Raji. My Defacto Presido.
227  Forum / Politics / Re: Adesiyan Admits Momoh, Obanikoro, Fayose, Omisore Colluded To Rig Ekiti Gov Poll on: 9-02-2015 12:53 PM
Vikkyid u keep asking this qustion. Obanikoro say, General, presido say make u use ur power disrupt APC, Arrest political bigwigs, restrict APC agent, make sure say na only PDP agent get free movement, if we win ur Promtion sure. If dat one no be rigging wetin im com be. Abi u don turn Bro Jona wey say naija no dey corrupt, na petty Stealing we dey do
228  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Presidency Has a Case To Answer On Leaked Ekiti Audio - Fashola on: 9-02-2015 12:44 PM
Many nigerians na sawdust dey their brain. Even with fact dem still dey follow one way like Zombie. Our suffer just dey start. This People Distrupting Progress wey una dey support go throw all of us inside poverty
229  Forum / Politics / Re: Poll Shift: Jonathan’s Campaign Billboard Set Ablaze In Abuja on: 9-02-2015 12:31 PM
This Promise and fail Govt. no tire person self. Dem promise us say dem go do election for Febuary 14 now dem cancel am. My woman don begin disturb me for Valentine. Valentine wey i think say i don dodge
230  Forum / Politics / Re: These Are The Real Reasons Why INEC Postponed General Elections on: 8-02-2015 04:12 PM
Onyiima, i no know who confuse pass, u or jonathan.
Dem build power stations yet light no dey
Agriculture don improve yet we still dey import rice and beans
Dem increase minimum wage for paper yet dem no allocate the money to states to disburse am
Railway don dey work... For which state and by the wey u don enter am?
Dem dey build new university yet lectures go strike for almost a year for lack of funding for the old ones
Dem create employment... Go ask how many people dem retrench after im sell Nepa to Ghost buyers
2013 and 2014 no cue... Ask people for Abuja and North weda dem see fuel buy easily
Free and fair elections. Im be like say na cotonou u dey when dem dey take soja and Dss dey harass APC politicians for Ekiti
Airport wear new look.. When last u enter plane? Port Harcourt International Airport na Canopy be arrival and Departure hall
Im build schu for alumajiri work im no creat wait for dem
Naija youth jobless sotey Yahoo pay pass bank work
Naira don weak sotey dodo strong pass am
and u sidon there dey promote PDP propanganda
Yéyé dey smell
231  Forum / The Buzz Central / Re: Ooops: Rich Folorunsho Alakija Didn't Make Forbes List Of Richest Women on: 7-02-2015 11:12 PM
All these people wey our ex Generals and politicians share oil blocks for go dey claim rich like say dem work pass my Mama wey dey hustle all day. Deeris GOD oooo
232  Forum / The Buzz Central / Re: Negative Publicity Of Whitenicious Has Made Me $10 Million Richer! - Dencia on: 7-02-2015 11:09 PM
The money no change the fact say soon ur hand go yellow, ur face go purple and ur yansh go black. Baba Fela no lie na
233  Forum / Politics / Re: EXPOSED: More Evidences That Shows That Ekiti State Guber Election Was Rigged on: 7-02-2015 11:04 PM
We all know wetin happen na. Afterall dem arrest El rufai, gov. Amaechi, Gov Oshomole and co for airport. Dem no even allow dem enter town. We all know how DSS boys dey flog politian and shoot anyhow for ekiti during the period. I f anu mumu doubt my story, i refer am to Vanguard and Punch
234  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: TF!?? Spoilt White Kid Buys 51-Year-Old Nigerian Man, Ezekiel As His Toy on: 7-02-2015 10:45 PM
All dis bullshit na for reality show. Before u know now u go see one reality show called my african toy
235  Forum / The Buzz Central / Re: Photos From Gorgeous Tiwa Savage's 35th Birthday Held Yesterday on: 7-02-2015 12:20 AM
Victornna, u be tata? Me i no sabi write english naim make i dey use pidgin always. Kenosas say im no understand u naim im mean by drift. Even me self i no understand ur initial comment not to talk of the reply. Abi na u and Uncle jona wife go the same schu? Who be ur pinspa self? Deeris GOD ooooo
236  Forum / The Buzz Central / Re: Gov. Fashola, Dare Art Alade & Other Stars Attend Olamide's Son Naming Ceremony on: 7-02-2015 12:12 AM
Some people sabi yarn anyhow. Wetin Fashola do wrong by celebrating life? Ola wey alow dem born the pickin no better pass u wey dey abort am?
237  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: PHOTOS: Alaafin of Oyo’s Wife, Badirat Adeyemi Celebrated Her Matriculation on: 6-02-2015 11:58 PM
Na ishawn, fuku and shaki naim generate that jaw
238  Forum / Politics / Re: Jonathan Rattled As ‘Sai Buhari’ Takes Over Kaduna PDP Rally; Police Chase Crowd on: 1-02-2015 07:56 PM
Yao yao PDP. Dem go hire crowd make stadium for full. Dem no know say dem hire APC supporters join.
239  Forum / The Buzz Central / Re: Olamide Baddo And Girlfriend Aisha Suleiman Welcome New Baby, Meet His New Son! on: 31-01-2015 08:54 PM
So dis na beta thing now abi? Dem just dey give girld belle anyhow. Why not settle down marry?
240  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: DRAMA! Prof Osinbajo Splashed N2000 On Security Guards At Galleria on: 29-01-2015 12:35 AM
no be tip dem dey tip waiter and gatemen dem? una be want make im give una salary?
Pages:
1 ... 9 10 11 [12] 13 14 15 ... 27