1. We have an extradition pact with the USA 2. The news is real. NDLEA is still surrounding his house 3. If he is innocent, let him follow dem now and sue them on Monday morning. Shikena
I be redeemer but I no support this donation. Why not donate the ambulance to Lagos emergency ambulance service. At least we dey see dem dey use their ambulance for accident victims. Charity should begin at home
Wetin stop dem from given the manager the police report so as for the corpse to enter morgue then proceed to the factory for proper investigation and if possible to the party venue to know wetin really happen. Instead the Dundee dem detain manager as if na the manager be the beginning and ending of their investigation. Ólòshi
I don tire for dis text book economics wey dis woman dey read for us. Na she tell us say naija economy naim be the largest for Africa yet we dey borrow money take pay salary. Under her watch dem chop our foreign reserve finish even though we dey make money in excess for 3and half years of her tenure. Which kain solid legacy she dey leave for us. Kpacharan yagi there
Wetin I'm for don do since naim im dey do for the eleventh hour. Im come even Employ Sanusi broda go there so the guy fit beg for am when yawa begin gas after may 29th
Admin by the way, wet in be una job? Dis useless poster facefacebppker wey dey insult our intelligence with her useless post, why una never bar her for the Nood post wey she put up here? And make una remove the thing with immediate alacrity. I no wan wake up see this nonsense tomorrow