To mess for public dey sweet but if dem catch you, no be small embarrassment o! Just follow this guidelines and you are on your way to being a star in this profession.
1. When you enter a hall, check the wind direction, if na closed hall with AC, better. Maximum impact guaranteed!!
... 2. Make sure say you sidon facing the wind direction.
3. Make sure say you get enough leg space. You go soon know why.
4. Try and form Ajebo by crossing your legs every now and then.
5. You don ready to execute, try hold am until time wey the hall dey noisy in case your mess na the type wey dey sound like AK47.
6. Now carefully cross your leg, right over left.
7. Elevate the right yansh lobe.
8. Release small (we dey call am sound check).
9. If no sound, you dey free to allow make the mess flow steadily.
10. Allow enough time for proper circulation.
SERIOUS NOTE:
i. Make sure say no be you be the first person to complain.
ii. When people begin dey shout say e no go better for the person wey do dis kind thing, simply ask "why person no go fit respect the presence of others naaa?"
iii. No hala pass others if not you go become suspect.
iv. Take style disengage from the area, relocate to another zone and repeat step 1 to 10 again.
Posted: at | |