But wetin dey worry airtel sef?
Naso I meet one fine babe for bus. I chyke her and
she follow up.we discuss dey catch fun dey go.as
I wan com down frm bus I com ask her for
numba. meanwhilemy fone don off. so I giv her my
numba and she promise to call me later dat
day.na so I go house dey happy. I rush charge my
fone. B4 I know call jus enta and na new numba
witout name.I was so happy dat d gal has finally
called.I jus pick d call behold I hear " welcome to
airtel online customer service,ring bak
subscription is free for 7 days" na so I faint.na for
dream I type dis tin,I neva recova......Airtel e no
go beta for una o
Posted: at | |