Dis country I no understand u enter kg1 u reach kg3 u write one exam to primary 1 u from primary 1 reach primay 6 u write only one exam to enter jss1 when u dey kg u write only one exam to primary when u enter primary u write only one exam to secondary then when u enter secondary u write 2 exams jss3 & ss3 exam then when u wan enter university u go write Waec or neco, jamb, post utme, such if u fail one u go re-enroll for them again Abeg I wan ask one question na so he b during d time of our fathers? Cos d country now anything them give us we go just dey play along all dis no b effort to take discourage brains from education becos them dey increase d no. Of exams to write just to gain admission into university just imagine after u don crack ur brain for Waec or neco finish u go come enter jamb after u crack ur head for jamb finish u go come enter post utme if u don crack ur brain for all dis finish which brain remain to use wen u eventually get admission, meanwhile white men wey bring dis education to us dem no crack head like dis y he b say anything white men bring for us we go like wan kill ourselves meanwhile at d end we go still come out with nothing cos ur b.sc here no go fit challenge high school degree for their side so y we dey fool ourselves u graduate as a mechanical engineering student company employ u dem go still send u on course cos dem know say WETIN u carry come na dirty d leaders just dey use all dis level take dey buy time for themselves if not cross check our leaders educational background u go see say 60 if not 70% of dem na Waec dem get يراقب الله !!!
Posted: at 19-11-2015 01:27 PM (8 years ago) | Gistmaniac |
|