Admin abeg i want make una ban Okatee bcos i go tif goat all bcos Slimmygal don promise to come for dinner dis wkend and me i no like d tin wey e go dey tell naijapals say na im dey marry Slimmygal and na d goat i wan cook for her and i no want disturbance....
Admin i no say una no dey listen but abeg una make at least for d 1st time make una listen to me...
Na so Gogoman and Eazy comot Ekaette from my hand una no do anytin, i no for a FACT say Gogoman hand dey for that Ekaette incident.
I vex small but not too much...
I dey go Okatee house go collect im clothes as instructed by my babalawo e no go crase but e no go remember Slimmygal at all at all, my babalawo don promise me dat.
So make una ban Okatee from now till sunday night...Abeg make una release Eazy bcos i wan beat small for snatching Ekaette, na small beating i promise just ordinary 60 lashes of koboko...
Dis na some of d tin i complain about cos una talk say una need to make changes to naijapals so dis is ur chance to prove to me say una dey serious..
Posted: at 24-06-2016 11:44 AM (8 years ago) | Hero |
|