my fellow naijapals, make una no ves oh, i no sabi talk gossip(dem say dem say), thats why i bring this matter come this area, i see something wey confuse my eyez well well, for one magazine dem write "TURAI GOES TO SKOOL OF MANNER"
ah, i come dey wonder whether na TURA SOAP or maybe dem make mistake add letter "I" for tura soap, but wait oh! soap no dey go skool now. ah ah wetin dis people mean now.
na him one of my friend wey get basket mouth com sey TURAI(our Presido wife) go skool for obodo oyibo(london) to go sabi how she go dey eat wit folk and knife and also to talk for public.
i say, i go first hear from my naijapals friend bcos na dem see pass CNN.
NA TRUE
Posted: at 28-11-2008 01:06 PM (16 years ago) | Gistmaniac
Kennycynth at 28-11-2008 01:30 PM (16 years ago) (f)
na question? black oyibo woman if you no sabi the answer waka pass, na em make una dey fail for exam i ask question instead of answer you dey give me anoder question on top. ah na waa oh.
Posted: at 28-11-2008 01:30 PM (16 years ago) | Gistmaniac