WARRI BOY INTERVIEW

Date: 06-04-2012 3:47 am (13 years ago) | Author: akpos alex
- at 6-04-2012 03:47 AM (13 years ago)
(m)
                                   The interview
        Ejiro was asked to complete the following in an interview:
1)     He who fights n runs away?
        Ejiro: e don surrender be dat na, na fear catch am.
2)     A rolling stone?... No fit just dey roll, na person push am.
3)     He who lives in a glass house?... Na rich politician be dat na.
4)     A stitch in time?... Dey prevent further tear tear.
5)     Birds of d same feather?... Na d same mama born them.
6)     One good turn?... Na correct power steering fit do am.
7)     A bird in hand?.. Wetin e wan be again if nor be barbeque. Dem plenty for chicken republic.
Cool    Half bread is better than?... Puff puff, buns or garri without sugar.
9)     A journey of a thousand miles?... Na d person wahala be dat na. Why e no enter car or aeroplane jeje.
10)   He who laughs last?...get brain problem. Make dem examine am becos na begining of madness be dat..
11)   A patient dog?... Don get disease. Na hunger go kill am.
12)   All work and no play?... Na bank job ooo bros.


Posted: at 6-04-2012 03:47 AM (13 years ago) | Newbie
- McGodstime at 6-04-2012 04:35 AM (13 years ago)
(m)
D guy 2 much
Posted: at 6-04-2012 04:35 AM (13 years ago) | Newbie
Reply
- akpos4 at 6-04-2012 04:58 AM (13 years ago)
(m)
thank you oh.
Posted: at 6-04-2012 04:58 AM (13 years ago) | Newbie
Reply
- jossy4reall at 6-04-2012 07:03 AM (13 years ago)
(m)
 Roll Eyes Roll Eyes

Posted: at 6-04-2012 07:03 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- zeigbo at 6-04-2012 07:07 AM (13 years ago)
(m)
Lol u try

Posted: at 6-04-2012 07:07 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- akpos4 at 6-04-2012 07:08 AM (13 years ago)
(m)
jossy e clear say ur palava full plate
Posted: at 6-04-2012 07:08 AM (13 years ago) | Newbie
Reply
- jossy4reall at 6-04-2012 07:14 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: akpos4 on  6-04-2012 07:08 AM
jossy e clear say ur palava full plate

hehehe...bros no take am personal ooo.........u suppose knw say dat my palava dey very small to compare wit ya own wey u load 4 container..come dey offload dem 4 hia

Posted: at 6-04-2012 07:14 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- zeigbo at 6-04-2012 07:30 AM (13 years ago)
(m)
Hehehehe jossy u yeyeoo Waitin him dey offload

Posted: at 6-04-2012 07:30 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- jossy4reall at 6-04-2012 07:41 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: zeigbo on  6-04-2012 07:30 AM
Hehehehe jossy u yeyeoo Waitin him dey offload

him dey offload all d yeyes wey u pack kip 4 dia houx Grin..... he say him no nid dem anymore

Posted: at 6-04-2012 07:41 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- franel at 6-04-2012 07:42 AM (13 years ago)
(m)
Guy, na wa o e b like say u want me to talk after seein dat what you posted its still on the first.

Posted: at 6-04-2012 07:42 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- zeigbo at 6-04-2012 08:02 AM (13 years ago)
(m)
Ok

Posted: at 6-04-2012 08:02 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- zeigbo at 6-04-2012 08:05 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: jossy4reall on  6-04-2012 07:41 AM
him dey offload all d yeyes wey u pack kip 4 dia houx Grin..... he say him no nid dem anymore

e dey offload am dey claim champion

Posted: at 6-04-2012 08:05 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- jossy4reall at 6-04-2012 08:27 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: zeigbo on  6-04-2012 08:05 AM
e dey offload am dey claim champion

u nkor....no be like dat u claim when u come new 4 hia

Posted: at 6-04-2012 08:27 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- queenrukky at 6-04-2012 11:44 AM (13 years ago)
(f)
 Lips Sealed
Posted: at 6-04-2012 11:44 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- francischi at 6-04-2012 05:44 PM (13 years ago)
(m)
 all post and no read ?   .................... na post before be that

Posted: at 6-04-2012 05:44 PM (13 years ago) | Hero
Reply
- akpos4 at 7-04-2012 01:14 AM (13 years ago)
(m)
oya make owna pin dwn.if u dey rise bfor nr vex.na wa oh.must dis tin pass person doormot
Posted: at 7-04-2012 01:14 AM (13 years ago) | Newbie
Reply
- joash2 at 7-04-2012 07:24 PM (13 years ago)
(m)
wait i nor understand oh.owna wan take panadol for he head.make owna leave he head to swell up na
Posted: at 7-04-2012 07:24 PM (13 years ago) | Newbie
Reply

Featured Discussions