vision impossible (Page 2)

Date: 17-01-2015 4:08 pm (9 years ago) | Author: immortal-jay™
1 [2] 3
- justmak at 23-01-2015 08:31 PM (9 years ago)
(m)
make I continue?YES or NO votes
   start now

Posted: at 23-01-2015 08:31 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- alabi22 at 24-01-2015 10:23 AM (9 years ago)
(f)
OK continue
Posted: at 24-01-2015 10:23 AM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rakelly at 24-01-2015 03:44 PM (9 years ago)
(f)
Yes
Posted: at 24-01-2015 03:44 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- omomarty at 24-01-2015 08:32 PM (9 years ago)
(f)
yes continue with your yeye
Posted: at 24-01-2015 08:32 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- justmak at 24-01-2015 10:43 PM (9 years ago)
(m)
one day like this nor go pass make me and
those Yoruba people no get Kanta. Dem go
kon worse matter say I be 'Omo nna'. Some
old old mama go wan use their age ride me.
Den go dey clear me say my grandfather no
reach them for age. Before before, me no dey
hear wetin dem dey tok, but as Sule don
brief me small, I begin dey use idea carry the
rest.
Na one mama vex me one day. She dey call
me 'olosi jatijati'. Na so I provoke call am
witch. I don tok am finish before I realise say
na born again I be.
I ask"Omo Iko, you know whether born again fit
do driver and kondo successfully?" I asked.
Omo Iko laugh.
"Before nko. No be born again I be too?"
I look Omo Iko from im head to toe. He ask
why I dey look am like that. I clear am say
him no be born again because I never see am
enter church before.
"MAK, you funny. You nor know say I be
born again moslem abi?"
Na the first time wey I go hear say moslem
sef dey born again be that.
I never do kondo pass five months before I
tok say I no wan do again. Na two times
agbero don drag me come down bus beat me
like say tomorrow nor dey, all because Omo
Iko no wan stop give them their 'entitlement'.
Now I kon dey reason am say Kondo no be
my destiny.

Posted: at 24-01-2015 10:43 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- omomarty at 25-01-2015 02:20 AM (9 years ago)
(f)
i can see the manifestation of your madness................. keep it up boi
Posted: at 25-01-2015 02:20 AM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rakelly at 25-01-2015 09:15 PM (9 years ago)
(f)
Give eraser make in clean some lines
Posted: at 25-01-2015 09:15 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- justmak at 26-01-2015 12:20 PM (9 years ago)
(m)
Quote from: omomarty on 25-01-2015 02:20 AM
i can see the manifestation of your madness................. keep it up boi
who be Ur boi u want make I tear Ur pant

Posted: at 26-01-2015 12:20 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- omomarty at 26-01-2015 09:41 PM (9 years ago)
(f)
my pant abi rakelly pant? Huh?
Posted: at 26-01-2015 09:41 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rakelly at 26-01-2015 11:14 PM (9 years ago)
(f)
Make I hear my name
The cutlass wey de my hand no be fancy
Posted: at 26-01-2015 11:14 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- justmak at 27-01-2015 01:46 PM (9 years ago)
(m)
rakelly I go tear Ur pant and Ur bra join

Posted: at 27-01-2015 01:46 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- justmak at 27-01-2015 01:46 PM (9 years ago)
(m)
rakelly I go tear Ur pant and Ur bra join,that Ur cutlass na play,

Posted: at 27-01-2015 01:46 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- omomarty at 27-01-2015 03:36 PM (9 years ago)
(f)
Quote from: rakelly on 26-01-2015 11:14 PM
Make I hear my name
The cutlass wey de my hand no be fancy

abeg go use am clear d bush wey de front of my house
Posted: at 27-01-2015 03:36 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- alabi22 at 28-01-2015 06:03 PM (9 years ago)
(f)
so u Don finally agree say na inside bush u dey live?
Posted: at 28-01-2015 06:03 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- alabi22 at 28-01-2015 06:04 PM (9 years ago)
(f)
so u Don finally agree say na inside bush u dey live?
Posted: at 28-01-2015 06:04 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rakelly at 28-01-2015 11:54 PM (9 years ago)
(f)
 Grin
Posted: at 28-01-2015 11:54 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- omomarty at 28-01-2015 11:56 PM (9 years ago)
(f)
Quote from: alabi22 on 28-01-2015 06:03 PM
so u Don finally agree say na inside bush u dey live?

grass de around my house since wey raki husband go bush go find meat come nai d grass take grow. come self na which b your own
Posted: at 28-01-2015 11:56 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- omomarty at 28-01-2015 11:57 PM (9 years ago)
(f)
Quote from: rakelly on 28-01-2015 11:54 PM
Grin

abeg close your teeth jare Angry
Posted: at 28-01-2015 11:57 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rakelly at 29-01-2015 12:01 AM (9 years ago)
(f)
Fine teeth no punples
Posted: at 29-01-2015 12:01 AM (9 years ago) | Hero
Reply
- omomarty at 29-01-2015 12:03 AM (9 years ago)
(f)
i pray ooooooooooooooooooooooooooo abeg nor de give urself hope again
Posted: at 29-01-2015 12:03 AM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
1 [2] 3