vision impossible

Date: 17-01-2015 4:08 pm (9 years ago) | Author: immortal-jay™
[1] 2 3
- at 17-01-2015 04:08 PM (9 years ago)
(m)
                 MY NAME NA JUSTMAK
                     THIS IS MY STORY
i be handsome guy; the kind wey woman go
fit trip for so tey dem go lose their balance.
For Okija my village that time, I know how
many girls don enter my trap nah! But since
way I don born again I no dey run that kind
parole again. Na person way I go fit marry I
dey find now.
I kuku know book when I dey secondary
school. Na first I dey carry every time. I
finish secondary kon write Jamb for 2009
Na since then Jamb don begin jam me o. No
be say I no dey pass JAMB, but the thing be
say na Melecin (Medicine) I wan read by
force by fire. If I get 280 na that time cut off
mark go be 281. Na UNIBEN I choose for my
first JAMB. Those yeye people kon go dey
offer me Botany say because I no reach cut
off.
Na my second JAMB funny pass. I beat cut
off wella; I score 292. I don even brag say
nothing dey happen I dey get admission that
year. I begin dey do cho, cho, cho up and
down so tey I go tell people wey no ask me
wetin I get. Na Unilag I choose that year. I
kukuma get people for Lagos wey I fit dey
live with. Dem say na 285 be cut off mark. Me don
kuku tidy cut off mark. Wet in remain nah?
Wetin fit stop me from getting admission this
year again? Post Jamb? Make I hear am.
Post Jamb wey start 2005? Guy, na 2010
matter be this o. Me don enter Melecin dis
year already, nothing fit stop me.
I even go do testimony for church. Kon see
how I just they jam tok for church. I just dey
add things wey no happen so tey I tok say I
do 3 months fasting and prayer for Mountain
of Fire before the exam. Me wey neva step
MFM dumult.
As I dey tok tok up and down na im I go
jamtok o. When my guy tell me say make I
dey pray about admission na im I provoke o.
"Uche, shut up your mouth! Wetin I need
pray about wen be say I don beat cut off
mark?" I yell on top my guy.
"MAK, na one dream I dream o. I dream
say one bird dey drag your admission letter
with you and the she bird finally succeed o.
The thing chop am for mouth dey fly go."
I laugh. E too funny. Na den I kon jamtok
say, "Even if dem go heaven go do admission
I go get am. Baba God sef nor fit stop me
from having Melecin."
To my surprise next day dem tok say dem
don release admission list o. That time I still
be novice for browsing. I carry Uche go cafe
make im helep me check my status. To my
surprise my name nor dey list. Which kind
thing be this? Hot mess begin dey comot . I
tell Uche say whether Na the Cafe no good.
Uche tell me say I dey craze.
Na so I see am o. Admission no show.
Shame no go gree me stay Okija. Na
travelling to Lasgidi go sure pass o. Make I
go Unilag go rake for them there. As I reach
Unilag them show me the new cut off mark.
Na 1 mark remain make I meet am. The
Prof. wey I meet there say nothing wey im fit
do o, because him be don use him slot
finish.
Them give me Fishery later sha.
"Who go do that kind course?" I laugh. Uncle
tok say e better make I go meet fishermen
for marina make them put me through before
I go go for the course finally.
"Tufiakwa!" I shouted. "Over my dead body."
Since that time I no just show for village o.
How I go take withstand the leering eyes of
all those villagers wey think say true true I
don enter school If den still see me around
wetin dem go begin yarn? thrash?
Walai Talai Lasgidi nor easy o. E never even
reach 2 weeks before my uncle ask me say
make I go find one work dey do to survive.
Wen I dey village I think say na mansion
Uncle Chike dey live ni o. Walahi if I no say
Na face me I face you I for no come here at
all..........readmore

Posted: at 17-01-2015 04:08 PM (9 years ago) | Gistmaniac
- giftmurphy at 17-01-2015 10:53 PM (9 years ago)
(f)
have faith Cheesy Cheesy
Posted: at 17-01-2015 10:53 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- justmak at 18-01-2015 04:17 PM (9 years ago)
(m)
Quote from: justmak on 17-01-2015 04:08 PM

Since then na im I don become Lagosian.
Which work I go fit do o? I ponder so tay na
bus conductor my mind just they go. Na mile
2 my Uncle dey live Bad boys boku for there
yanfun yanfun. If I tell one of them say I
wan do conductor, e go fit arrange one
motor give me nah. I hear say conductors
dey make nothing less than 2K per day.
Na Sule I go meet that time. The guy too like
smoke. Me no like smoke at all. I nor know
wetin den dey gain inside for this our hot
weather.
Sule get deep voice. Everything about Sule
na soso deep deep. E get plenty deep cut for
body; he like make e dey wear one deep blue
dirty jacket.
Sule na confirm conductor for Ketu-Ojota
road. Sometimes he go also do Agbero-na
swapping things o--one way nor enter market
nah.
Sule connect me with Omo Iko. Omo Iko
worse pass Sule for appearance. Im ma na
driver. Na im I go dey do conductor for.
Na so I begin work with Omo Iko o. When I
first start, shame nor dey gree me shout to
call passenger inside bus, but when Omo Iko
scolded me two times I begin wise. For start,
me no dey get kanta with Omo Iko, but when
he begin send me Cigar na im we begin get
wahala. Me be brief am say me nor fit dey
helep am buy Cigar because my religion nor
support am. Omo Iko look my face laugh.
"You no know anything," said Omo Iko. You
know whether your pastors sef dey smoke
for corner?"
"E no fit possible egbon," I tell am.,,,,,,,  readmore

Posted: at 18-01-2015 04:17 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- brightossy at 18-01-2015 06:02 PM (9 years ago)
(m)
naa uur tru life story?
Posted: at 18-01-2015 06:02 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- justmak at 18-01-2015 06:41 PM (9 years ago)
(m)
Quote from: brightossy on 18-01-2015 06:02 PM
naa uur tru life story?
u swallow snake na Ur own e for be b4

Posted: at 18-01-2015 06:41 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- justmak at 18-01-2015 06:57 PM (9 years ago)
(m)
Quote from: justmak on 18-01-2015 04:17 PM
Since then na im I don become Lagosian.
Which work I go fit do o? I ponder so tay na
bus conductor my mind just they go. Na mile
2 my Uncle dey live Bad boys boku for there
yanfun yanfun. If I tell one of them say I
wan do conductor, e go fit arrange one
motor give me nah. I hear say conductors
dey make nothing less than 2K per day.
Na Sule I go meet that time. The guy too like
smoke. Me no like smoke at all. I nor know
wetin den dey gain inside for this our hot
weather.
Sule get deep voice. Everything about Sule
na soso deep deep. E get plenty deep cut for
body; he like make e dey wear one deep blue
dirty jacket.
Sule na confirm conductor for Ketu-Ojota
road. Sometimes he go also do Agbero-na
swapping things o--one way nor enter market
nah.
Sule connect me with Omo Iko. Omo Iko
worse pass Sule for appearance. Im ma na
driver. Na im I go dey do conductor for.
Na so I begin work with Omo Iko o. When I
first start, shame nor dey gree me shout to
call passenger inside bus, but when Omo Iko
scolded me two times I begin wise. For start,
me no dey get kanta with Omo Iko, but when
he begin send me Cigar na im we begin get
wahala. Me be brief am say me nor fit dey
helep am buy Cigar because my religion nor
support am. Omo Iko look my face laugh.
"You no know anything," said Omo Iko. You
know whether your pastors sef dey smoke
for corner?"
"E no fit possible egbon," I tell am.,,,,,,,  readmore
Omo Iko begin yarn me tori. He tell me about
one ogbonge pastor wey dey follow them
smoke for their cabal. I no believe the story.
When Omo Iko wan use force take dey send
me Cigar, I tell am say my mama nor go like
am. Omo Iko ask me say whether na me wan
go tell am. Na so I give myself brain kon dey
helep am buy smoke o, because im be don
clear me say if I nor fit do am then hin go
tender my conductor 'sack letter'. Me no wan
lose my job o. E beta make I use my sense
now o.
Omo Iko go dey smoke dey puff the smoke
for my eyes. Hin go dey ask me whether me
sef wan puff small. I clear am say I no fit do
am.
"Omo ole," hin go tok but me never know the
meaning that time because na yoruba
language hin take tok am.
Omo Iko no really bad like that. Apart say hin
dey smoke, hin no too too dey do bad bad
things. I never hear Omo Iko dey insult
people inside bus before. I go say na him be
the most gentle driver wey I know. The
single dey wey I follow Sule do conductor, I
no fit count how many people hin abuse
finish. As e dey abuse car owner na so hin
go dey abuse okada riders. Even hin
passengers no fit escape hin bad mouth.
Na from Sule mouth I learn how den dey
curse person 'olosi' and 'oloriburuku'. That
time I nor know wetin dem mean. I don sabi
tok am wella so tay I no fit stop again wen I
later know say na big curse dem be.
Omo Iko no dey tok them sha. I surprise say
hin just gentle like that. How that kind thing
take dey possible? With the way hin head
even be sef, you go know say na confirm
'Omo ita' hin be. Omo Iko right face swell up
pass hin left face. If you dey look Omo Iko
from one side you go think say na only one
cheek hin get, because the one wey swell up
don cover the other side. Na 31 teeth hin kon
get sef, meaning say den don use ogbonge
blow pluck am comot before. How come hin
kon cool like that?
I just too dey inquisitive. I wan know wetin
happen wey make Omo Iko gentle like that.
Na Sule kon clear me for that matter later.
He tell me say Omo Iko  da smoke Igbo well well na dat day I no say Igbo da make person d gentle na how I begging hide smoke igbo be dat ,,,,,,,,,,,,readmore

Posted: at 18-01-2015 06:57 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- giftmurphy at 18-01-2015 10:27 PM (9 years ago)
(f)
too long!!giv summary Roll Eyes
Posted: at 18-01-2015 10:27 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- justmak at 18-01-2015 10:35 PM (9 years ago)
(m)
Quote from: giftmurphy on 18-01-2015 10:27 PM
too long!!giv summary Roll Eyes
I being da tell u da story b4,na true life story oo

Posted: at 18-01-2015 10:35 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- giftmurphy at 18-01-2015 10:57 PM (9 years ago)
(f)
Quote from: justmak on 18-01-2015 10:35 PM
I being da tell u da story b4,na true life story oo
ok im gonna take tym to read it!! Roll Eyes
Posted: at 18-01-2015 10:57 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- rakelly at 19-01-2015 01:27 PM (9 years ago)
(f)
Rubbish
How I go dey read this novel
Posted: at 19-01-2015 01:27 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- justmak at 19-01-2015 02:51 PM (9 years ago)
(m)
I understand ur problem prl rakelly no warry urself just go da sale Ur fura d nono.duru wanchi

Posted: at 19-01-2015 02:51 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- omomarty at 19-01-2015 04:37 PM (9 years ago)
(f)
guy u nor tell me say na novel u wan begin de write dis year ooooooooooooooooo well continue
Posted: at 19-01-2015 04:37 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- jossy4reall at 20-01-2015 06:12 AM (9 years ago)
(m)
I want to sing a song and it goes like this.......someone pls call 911....tell them that he needs big chain.............

Posted: at 20-01-2015 06:12 AM (9 years ago) | Hero
Reply
- francischi at 20-01-2015 10:20 AM (9 years ago)
(m)
Haleluya somebody

Posted: at 20-01-2015 10:20 AM (9 years ago) | Hero
Reply
- francischi at 20-01-2015 10:20 AM (9 years ago)
(m)
Haleluya somebody

Posted: at 20-01-2015 10:20 AM (9 years ago) | Hero
Reply
- rakelly at 21-01-2015 08:01 PM (9 years ago)
(f)
Jossy where you from come self
Posted: at 21-01-2015 08:01 PM (9 years ago) | Hero
Reply
- justmak at 22-01-2015 10:34 PM (9 years ago)
(m)
na jossy no make me complete my torry and rakelly

Posted: at 22-01-2015 10:34 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- omomarty at 22-01-2015 10:39 PM (9 years ago)
(f)
 Roll Eyes Roll Eyes Roll Eyes Roll Eyes
Posted: at 22-01-2015 10:39 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- alabi22 at 23-01-2015 07:00 PM (9 years ago)
(f)
justmak....this is anoda weed story I guess
Posted: at 23-01-2015 07:00 PM (9 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rakelly at 23-01-2015 07:51 PM (9 years ago)
(f)
Name the conclusion
Posted: at 23-01-2015 07:51 PM (9 years ago) | Hero
Reply
[1] 2 3