Show Posts
Pages:
1 ... 33 34 35 [36] 37 38
701  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: 26 parties team up to unseat Fashola on: 14-10-2010 02:20 AM
wetin una dey talk sef, shebi na wuruwuru Fashola take win for 2007, make another person use wuruwuru win too. wetin e do for lagos? bacause e patch oshodi and lagos-island una de jump up. una no know say lagos be like where dem de baf pig. if fashola dey there for next term na dat time una go hear am.
702  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: N70 Palavar: Housewife Docked For Killing Husband on: 14-10-2010 01:46 AM
if say the woman dey do alabaru e for dey help. poverty don dislodge her medula oblongata, see as she do face like ijebu gorila
703  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Poisonous amala meal on: 14-10-2010 01:26 AM
amala don sofa soteee e begin to injure people abi na person use am to injure person, i no fit tell
704  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: FATAL SEX: About-to-wed lady dies under DPO on: 14-10-2010 01:22 AM
i tell una say this country na curse hol am to progress. no weapon wey devil no go use to operate for this country. me i don tire sef. see police rape woman for im office, chai even sodom and gomora beta pass naija sef
705  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: My German Embassy lover impregnated me and fled on: 12-10-2010 11:10 PM
i don talk am before say that girl na one foolish and hopless idiot. at the age of 29 she no get sense. nobody should blame the white guy. d girl carry her dirty honeypot give am and u wan make d man just de look am, tell me now.
706  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Cecilia Ibru very ill on: 12-10-2010 09:22 PM
oga dis ya grammer too much o, but sha that woman na devil
707  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Bomb scare in Zamfara ahead of Jonathan’s visit on: 12-10-2010 09:19 PM
if dem start to dey blow demsef up for public that mean say to ur tent o israel.
708  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Law and Disorder In Lagos State BBC [Video Inside] on: 12-10-2010 09:13 PM
wetin be the beta thing wey somebody fit show for naija sef. e beta make dem dey show bad bad things so dat naija go dey popular and so dat we go know weda all those foolish area boys fit change. in short i no think so
709  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Kaduna govt announces N8,799 as new minimum wage on: 12-10-2010 09:07 PM
money wey no reach 100 dollars dem take mouth dey talk am. Ha my God save naija. una wan tell me say na that amount a worker go depend on for one month. no wonder bribery and corruption dey reign for naija
710  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Cameroon Blacklists T. B. Joshua on: 12-10-2010 08:55 PM
Quote from: sing on 12-10-2010 06:59 PM
the bible says by their fruits, we shall know them. if the pastor has dermonic fruits, she shall be known by it.
ol boy devil don dey computerized now o. even if de man be demon u no go know until e go retire because beta people no too dey for naija again.
711  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: N70 Palavar: Housewife Docked For Killing Husband on: 12-10-2010 08:48 PM
na de tin wey poverty de cause. ordinary 70 naira, money wey no reach to buy bottle of malta guiness
712  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Prominent Islamic Preacher, Sheik Bashir Mustapha, Killed By Boko Haram Militant on: 12-10-2010 08:44 PM
people wey be say dem no get commonsense, dem dey think like malu. dem wan turn naija to somalia but God no go gree for dem.
713  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Dangote donates N100m to flood victims on: 12-10-2010 08:35 PM
abeg make we hear word, all dis one wey una just dey salute like small pikin. de man give una back wetin e dey take from una, all de shipload of raw materials wey de enter for apapa wharf de man no dey pay custom duty at all. every three months de man trailer go kill 30 people for road side. na so de man de conive wey dem de chase lebanese people comot for naija sake of say dem sabi bizness pass am. de money wey e give sef no reach 1 million dollars una de make noise.
714  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: FG to generate one million jobs in six months on: 12-10-2010 08:24 PM
1 million jobs for where, to sell akara abi na moi-moi. abeg make we hear word joo, na today
715  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: My German Embassy lover impregnated me and fled on: 5-10-2010 03:36 AM
Quote from: sismaila3 on  5-10-2010 03:32 AM
Smiley Cheesy Shocked Cool She no like Nigerian made. Got her deserved reward.
thank u
716  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Nigeria Police Declare Two People Wanted Over Independence Day Car Bombs on: 5-10-2010 03:35 AM
Quote from: sismaila3 on  5-10-2010 03:28 AM
MEND reported 1 hr to time of blast that they will act on that venue, but since they got presidential exoneration, then catch anybody you see on the road.
my sister no be MEND report anything, dem just use MEND name de act
717  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Jonathan sacks GOC on: 5-10-2010 03:25 AM
Quote from: ajanni on  4-10-2010 05:04 AM
your papa and mama have started sheding their tears already , you that pure animal , stupid and useless , bo be inside poverty them born you so ? na so you must die too inside poverty now just like that of your useless parents too , stupid animal that will always comes from a village to spoils the town , donkey head , E no go better for you so oooo
na madness de worry u so, foolish man. e no go beta for ur family
718  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Gunmen invade church, abduct 3 in Owerri on: 5-10-2010 02:19 AM
which kind of thing be dis for goodness sake. may God come to their rescue
719  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Another six students kidnapped in Aba on: 5-10-2010 02:12 AM
dose kidnappers  r just a gang of hungry bandits sponsored by dose greedy rich men in aba
720  Forum / Naijapals Base (Metro life) / Re: Nigeria’s $480m idle in NY on: 5-10-2010 02:04 AM
delay tactics to embezzle the money
Pages:
1 ... 33 34 35 [36] 37 38