Shey you bi 'Ajebota' or 'Paki' ?

Date: 30-03-2009 3:22 am (15 years ago) | Author: Femi
[1] 2 3 4 5
- at 30-03-2009 03:22 AM (15 years ago)
(m)
12 diferent diferent ways wey you go take no am.

   1. If you see sey Madam, Sir or Esq na hin dey di back of yua papa en mama dem leta, Bobo,dem buta una bread!  You fit bi Ajebota.
   2. But, if dem refer to yua papa en mama as "Iya ibeji", "Mama-bonboy", "Mama Chukwudi", or " Baa Lamidi", Walai! you no bi ajebota!! Paki no 1 na im you bi.
   3. If for una house, na regularly all corner corner for una house dey get fumigated with Pest repellants wey dey waya all di kokroaches an termites comot patapata. My fren you fit bi Ajebota. But if  like play like play, Kondishon con get as e bi, you kon expert. wey yua cortiner or skoll slipas fit taget an nak kokroch wey dey fly. My broda, you bi Paki special.
   4. If for una family, na soso wallets and purses una dey keep mony, den bodi dey inside cloth ,idey posibu you bi Ajebota.                  Bo ! if yua mama take confido comot ego for im brekoyan wey local champions dey yanfu yanfu, yua Paki na serios level o!
   5. For una compound,  kom rain kom sun kanga dey for wata, Ajebota na im una dey. O'boy if di middle of una head don carry wata sote, wey di hair don dey gif way small small. A swel to god, una be Paki.
   6. If yawa don gas! wey nature dey call, you go download for toilet finish, acada kom make una klin sonthing with different different toilet paper. man, you be anoda Ajebota. If wata kon pas gari, na di wata you take 'tamba' ya sef. I no go desif you,na real Paki una be.
   7. If na toothbrush una take dey comot all di craw craw for una mouth efry morin, Walai, a no go do bend-bend for una .Na Ajebota no 1 una bi. If afta chewing una pako, una family fit spit di pako-wata for mouth reach 50 meters!  K-leg don enta di mata o!! una Pakiness don accelerate reach 10!!!
   8. If you sef get underwaer wey get elastic at di waistline,beta chasis dey onda, na one kain confido you dey take waka in front of opekes afta new catch. Alan pozza ! yua Ajebota. If kondishon make crayfish bend, man juss dodge enta bed, with dat kain onderwear wey get drawstrings en resembul di flag of Ghana, Chei ! A beg comot for road, you bi real 'Ajepaki Special.'
   9. Ma fren, If yua home dey wired,you don arrive,you dey bam,for una compand camera dey,dogs dey baff,barbed-wire pleti,security alarm kom top am. Na baba God na im sabi una.fit be four-one-sontin? Den no born nobody reach, you be 'modern' Ajebota. But come o! If all area boys and 'igida eiye fo' & co dey scared despite dem gbana to scale una fence, bicos of Tori wey don saculate sey una family don bury "Shigidi" (ari ma lee lo,Awo pada seyin) put for entrace! . Bobo, yua origina Paki.
  10. If una leg no dey house,na saloon bi di main thin for Naija to 'oganise' di bush wey dey una head, listen well well, a no go play you wayo, I raise hand for you o! without sapele wata,una bi first class Ajebota. But mai sista, if you and yua 'onidiri' sidawn for 6 awas for 'apoti' onda tree, wey she dey wala yua hair, no bi sey na go come! sontin dey there, suffer head no get beta name, go sima sista! The thin bi sey, a troway face say am...You bi 'new mellinium' Paki.
  11. Hunnn...e go beta now, A beg, if financial hardship con hit una sotee ! Hongry waya una well-well,una bekom by force Vegetarian, thin wey man hear for una mouth for buka bi sey...Madam, gi mi 4 naira eba, kon top am wi Ogbono without. Yua wata don pass gari o! I sweer, mai broda you bi Ajepako.
  12.

      Finally, make i nak you di thin wey dey swell mai belle. If una area girls kom semmer for bobo-bomboy, by di means of foreplay, mony for hand back for ground, tori kon get k-leg for bed. una two kon dey kanpe for awas!  Viagragra dey work!! Oga driver kon release brake lights!!! Imagency trafiketo dey like dele!!!! Almighty Rain kon blow Tonda 'Agbara Ojo' kon skata-skata efrytin.....una kon dey Kuleeeeee. Job wel don mai broda,yua di shon of di shoil. You bi modan Ajebota. If you try thin afta dark with yua woman, wey she no wan take eye koro-koro si am happen, im bodi sef no dey down, she kon vess sey: "Baa Karimu, E se'nte se, E ye f'ori omu si e" Awa aunty, Bodi do mi for you,Den need you for Adult education Centa. Ajepaki na yua appelasion!   

Posted: at 30-03-2009 03:22 AM (15 years ago) | Gistmaniac
- Toks-E at 30-03-2009 03:23 AM (15 years ago)
(m)
brb, by 9:00 am

Posted: at 30-03-2009 03:23 AM (15 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Emmanuel4christ at 30-03-2009 03:25 AM (15 years ago)
(m)
brb by 28gmt..
Posted: at 30-03-2009 03:25 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Gwhy at 30-03-2009 04:54 AM (15 years ago)
(m)
Brb 25:00 GMT

Posted: at 30-03-2009 04:54 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- omatseye at 30-03-2009 07:35 AM (15 years ago)
(m)
NICE 1 ...
Posted: at 30-03-2009 07:35 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- emmymth at 30-03-2009 10:42 AM (15 years ago)
(m)
nice one guy.Pls try dey shorten ur posts.U can split diz posts into three and title 1,2,3

Posted: at 30-03-2009 10:42 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- iphie at 30-03-2009 10:58 AM (15 years ago)
(f)
wake me up next ming dynasty (yawwwwwwwwwwwwwwwwwwnnnnnnnnnn) ....................sssssssssnnnnnnnnnnnnnnnnnnnnoooooooooorrrrrrrrrrrrrrrrriiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiinnnnnnnnnnnnnnnggggggggggg
Posted: at 30-03-2009 10:58 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Gwhy at 30-03-2009 11:23 AM (15 years ago)
(m)
Hw d tin dey do u na?
U wan mak everybodi knw say na my place u spent wkend?
Ds 1 wey u dey say mak dem wake u up,ok o ya wake up o monday don reach@ iphie

Posted: at 30-03-2009 11:23 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- federico at 31-03-2009 01:47 PM (15 years ago)
(m)
this thing too long na..i nor even fit read am
Posted: at 31-03-2009 01:47 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- degreatest2 at 31-03-2009 01:56 PM (15 years ago)
(m)
this boy needs "agbo iba ponju ponto"
Posted: at 31-03-2009 01:56 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- federico at 31-03-2009 02:02 PM (15 years ago)
(m)
nor mind am greatest,the guy even add him papa pic join the joke.na wa for am
Posted: at 31-03-2009 02:02 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- degreatest2 at 31-03-2009 02:11 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: federico on 31-03-2009 02:02 PM
nor mind am greatest,the guy even add him papa pic join the joke.na wa for am
chei! this hin papa picture wey i dey luk no resemble ajebota oh! e no even look like ajepaki sef!!!! na aje- nuthing nuthing!
Posted: at 31-03-2009 02:11 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- federico at 31-03-2009 02:13 PM (15 years ago)
(m)
who talk say na ajebota nicky bi b4?
Posted: at 31-03-2009 02:13 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- degreatest2 at 31-03-2009 02:32 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: federico on 31-03-2009 02:13 PM
who talk say na ajebota nicky bi b4?
na Aje nuthing nuthing!
Posted: at 31-03-2009 02:32 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- federico at 31-03-2009 02:33 PM (15 years ago)
(m)
abi
Posted: at 31-03-2009 02:33 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- skarfies at 31-03-2009 03:01 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: nickyvil on 30-03-2009 03:22 AM
12 diferent diferent ways wey you go take no am.

   1. If you see sey Madam, Sir or Esq na hin dey di back of yua papa en mama dem leta, Bobo,dem buta una bread!  You fit bi Ajebota.
   2. But, if dem refer to yua papa en mama as "Iya ibeji", "Mama-bonboy", "Mama Chukwudi", or " Baa Lamidi", Walai! you no bi ajebota!! Paki no 1 na im you bi.
   3. If for una house, na regularly all corner corner for una house dey get fumigated with Pest repellants wey dey waya all di kokroaches an termites comot patapata. My fren you fit bi Ajebota. But if  like play like play, Kondishon con get as e bi, you kon expert. wey yua cortiner or skoll slipas fit taget an nak kokroch wey dey fly. My broda, you bi Paki special.
   4. If for una family, na soso wallets and purses una dey keep mony, den bodi dey inside cloth ,idey posibu you bi Ajebota.                  Bo ! if yua mama take confido comot ego for im brekoyan wey local champions dey yanfu yanfu, yua Paki na serios level o!
   5. For una compound,  kom rain kom sun kanga dey for wata, Ajebota na im una dey. O'boy if di middle of una head don carry wata sote, wey di hair don dey gif way small small. A swel to god, una be Paki.
   6. If yawa don gas! wey nature dey call, you go download for toilet finish, acada kom make una klin sonthing with different different toilet paper. man, you be anoda Ajebota. If wata kon pas gari, na di wata you take 'tamba' ya sef. I no go desif you,na real Paki una be.
   7. If na toothbrush una take dey comot all di craw craw for una mouth efry morin, Walai, a no go do bend-bend for una .Na Ajebota no 1 una bi. If afta chewing una pako, una family fit spit di pako-wata for mouth reach 50 meters!  K-leg don enta di mata o!! una Pakiness don accelerate reach 10!!!
   8. If you sef get underwaer wey get elastic at di waistline,beta chasis dey onda, na one kain confido you dey take waka in front of opekes afta new catch. Alan pozza ! yua Ajebota. If kondishon make crayfish bend, man juss dodge enta bed, with dat kain onderwear wey get drawstrings en resembul di flag of Ghana, Chei ! A beg comot for road, you bi real 'Ajepaki Special.'
   9. Ma fren, If yua home dey wired,you don arrive,you dey bam,for una compand camera dey,dogs dey baff,barbed-wire pleti,security alarm kom top am. Na baba God na im sabi una.fit be four-one-sontin? Den no born nobody reach, you be 'modern' Ajebota. But come o! If all area boys and 'igida eiye fo' & co dey scared despite dem gbana to scale una fence, bicos of Tori wey don saculate sey una family don bury "Shigidi" (ari ma lee lo,Awo pada seyin) put for entrace! . Bobo, yua origina Paki.
  10. If una leg no dey house,na saloon bi di main thin for Naija to 'oganise' di bush wey dey una head, listen well well, a no go play you wayo, I raise hand for you o! without sapele wata,una bi first class Ajebota. But mai sista, if you and yua 'onidiri' sidawn for 6 awas for 'apoti' onda tree, wey she dey wala yua hair, no bi sey na go come! sontin dey there, suffer head no get beta name, go sima sista! The thin bi sey, a troway face say am...You bi 'new mellinium' Paki.
  11. Hunnn...e go beta now, A beg, if financial hardship con hit una sotee ! Hongry waya una well-well,una bekom by force Vegetarian, thin wey man hear for una mouth for buka bi sey...Madam, gi mi 4 naira eba, kon top am wi Ogbono without. Yua wata don pass gari o! I sweer, mai broda you bi Ajepako.
  12.

      Finally, make i nak you di thin wey dey swell mai belle. If una area girls kom semmer for bobo-bomboy, by di means of foreplay, mony for hand back for ground, tori kon get k-leg for bed. una two kon dey kanpe for awas!  Viagragra dey work!! Oga driver kon release brake lights!!! Imagency trafiketo dey like dele!!!! Almighty Rain kon blow Tonda 'Agbara Ojo' kon skata-skata efrytin.....una kon dey Kuleeeeee. Job wel don mai broda,yua di shon of di shoil. You bi modan Ajebota. If you try thin afta dark with yua woman, wey she no wan take eye koro-koro si am happen, im bodi sef no dey down, she kon vess sey: "Baa Karimu, E se'nte se, E ye f'ori omu si e" Awa aunty, Bodi do mi for you,Den need you for Adult education Centa. Ajepaki na yua appelasion!   


 :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'( :'(.......DOUBLE WAHALA 4DEADBODY.....I PITY U GAN..OOOOO....DIS URLIF STORY NO EASY OOOO..... :'( :'( :'( :'( :'( :'( WE DEY W8 VOL:13 OOO.SHA....TRY EN SPLIT NEXT TIME....DIS 1 DON PASS SUPER BOOK  SELF....NICE TRY
Posted: at 31-03-2009 03:01 PM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- stripod102 at 31-03-2009 03:07 PM (15 years ago)
(m)
hmmm..na the guy write super sotry na....nice 1 sha
Posted: at 31-03-2009 03:07 PM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- dinho4lyf at 31-03-2009 03:09 PM (15 years ago)
(m)
aje pakrity
Posted: at 31-03-2009 03:09 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- stripod102 at 31-03-2009 03:10 PM (15 years ago)
(m)
dinho.....u better go join ur collegues for san siro...
Posted: at 31-03-2009 03:10 PM (15 years ago) | Upcoming
Reply
- nickyvil at 31-03-2009 11:10 PM (15 years ago)
(m)
abeg if na papa be that leave am which one be you dagreatest or logreastest sey me and you no be d same ajenuthing try give yourself brain oo or else you go chop gala infront of BRT
Posted: at 31-03-2009 11:10 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
[1] 2 3 4 5