Night Club.
- Na God go slap ur mouth.
* U come back from dubai dey
form British accent.
- Na rat go chop ur mouth
* U be house boy u come dey
play Rick Ross - I am the Boss.
-4 where na.....mumu
* U dey add water to egg say e
go plenty when u fry am.
- Why u no add yeast join
am....olodo.
* U no go university, and u dey
find ur name for NYSC posting.
- Na yeye dey worri u.
* House dey burn, you wan use
gas do fire extinguisher
- Hahahahaha....u don die.
* U de say Terry G's music dey
inspire u
- unto which level!! madness
* U carry candle dey look for
where fuel dey smell from.
-continue u go soon see am
* U call MTN to tell dem sey ur
free
browsing has stopped working.
- Lolzzzzzzzzz... ..mad man
* When pastor talk say 'Do
something crazy for the Lord' u
come carry church offering run
- na who wan chase u?.....
* U read dis n u no wan share am
wit Ūя̲̅ padis wen u smile finish
- na only u de Stingy 2 d last...
Posted: at | |