Akpos :- Papa, See my result, Na me carry 3rd.
Papa Akpos :- Hahahaha, Akpos Akpos! Na now I know say
na me born you.
Akpos :- Shey I tell you na. All those time I dey carry
35th..Na the teachers dey do ojoro, They know say I too
brilliant.
Papa Akpos :- I believe you my boy. Na now I fit buy that
Bicycle wey you see for Papa Metus shop !
Akpos :- Papa na u biko. You get mouth pass BasketMouth.
Papa Akpos :- but, Who be the two idiots wey pass u sef
Akpos?
Akpos :- Na one WIZARD wey be Isaac and one WITCH wey
be Patience.
Papa Akpos :- No mind them, You go show them next term.
But who you come pass na? I no say dem plenty and you
no fit mention all of them, I just wan know how many of
una dey class.
Akpos :- Na just the three of us I don mention so na… Isaac,
Patience and Me. Na just the three of us PRINCIPAL put for
Elementary Class ‘F’ !!!
Na im Akpos papa just land for floor, gboossa, faint o!!
Posted: at | |