CHAMPION

Date: 29-11-2010 10:01 am (13 years ago) | Author: Digitalman
[1] 2 3 4 ... 6
- at 29-11-2010 10:01 AM (13 years ago)
(m)
This two friends wan pronounce ''champion''

Two friends go for their village stadium go watch football match.

So as dem dey watch na, one of the players com dey display plenty football tricks and styles in football.

na him one of those two friends com say ''huh, that player na sampion oo'', na him the other friend com tell am say

''no be sampion dem dey call am''

the first friend com say ''wetin dem dey call am''

the second friend said '' na yampion''

 Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin


Posted: at 29-11-2010 10:01 AM (13 years ago) | Addicted Hero
- Skypon2002 at 29-11-2010 10:03 AM (13 years ago)
(m)
abeg oooo,
make una no yab me too much
 Grin Grin Grin Grin

Posted: at 29-11-2010 10:03 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Kristiantus at 29-11-2010 10:05 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: Skypon2002 on 29-11-2010 10:01 AM
This two friends wan pronounce ''champion''

Two friends go for their village stadium go watch football match.

So as dem dey watch na, one of the players com dey display plenty football tricks and styles in football.

na him one of those two friends com say ''huh, that player na sampion oo'', na him the other friend com tell am say

''no be sampion dem dey call am''

the first friend com say ''wetin dem dey call am''

the second friend said '' na yampion''

 Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin
Embarrassed Angry Angry
skypon, if to say na me be m.o.d ehn... na to carry you go back to 1 post... which kin olden dayz joke be dis.? Angry
Posted: at 29-11-2010 10:05 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- Kristiantus at 29-11-2010 10:09 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: Skypon2002 on 29-11-2010 10:03 AM
abeg oooo,
make una no yab me too much
 Grin Grin Grin Grin
Angry Angry Angry
and e still dey funny to you abi? Angry
you come here dey yarn dust say na joke...
Posted: at 29-11-2010 10:09 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- Skypon2002 at 29-11-2010 10:13 AM (13 years ago)
(m)
today na him i know say kris no like me,
so u go like make i go back to post 1

thank God say u no be m.o.d.
 Grin Grin Grin

Posted: at 29-11-2010 10:13 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Kristiantus at 29-11-2010 10:14 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: Skypon2002 on 29-11-2010 10:13 AM
today na him i know say kris no like me,
so u go like make i go back to post 1

thank God say u no be m.o.d.
 Grin Grin Grin
you yeye ooo... i swear.. Angry
Posted: at 29-11-2010 10:14 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- Don-ziggy at 29-11-2010 10:19 AM (13 years ago)
(m)
appreciate person for once
Posted: at 29-11-2010 10:19 AM (13 years ago) | Upcoming
Reply
- felixomosexy at 29-11-2010 10:25 AM (13 years ago)
(f)
gud one bt na my tribe dey talk lik datooooooooooo
Posted: at 29-11-2010 10:25 AM (13 years ago) | Upcoming
Reply
- florish4love at 29-11-2010 10:28 AM (13 years ago)
(f)
hmmmmmmmm

skypon u try small
e dey funny nah
Posted: at 29-11-2010 10:28 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Kristiantus at 29-11-2010 10:38 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: Don-ziggy on 29-11-2010 10:19 AM
appreciate person for once
Huh? Huh? Angry
so i be wicked person abi... you dey try tell me say abi devil abi... Angry
Posted: at 29-11-2010 10:38 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- Kristiantus at 29-11-2010 10:39 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: florish4love on 29-11-2010 10:28 AM
hmmmmmmmm

skypon u try small
e dey funny nah

Huh? Huh? Sad
Posted: at 29-11-2010 10:39 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- florish4love at 29-11-2010 10:40 AM (13 years ago)
(f)
kris wetin do ya mouth oya laugh

b4 i go flog u
Posted: at 29-11-2010 10:40 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- terryworld at 29-11-2010 10:41 AM (13 years ago)
(m)
omg so skypon ur mind,brain,keyboard,soul,spirit.eye,hand,mouse,head,and tenis gree u post dis kind tin.
Ur first ever joke na dis rubbish.
Infact u self na zampion.

Posted: at 29-11-2010 10:41 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- Kristiantus at 29-11-2010 10:42 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: florish4love on 29-11-2010 10:40 AM
kris wetin do ya mouth oya laugh

b4 i go flog u
Sad Sad Angry
see no let me translate wetin dey my mouth for you oo...
just leave me jeje... Angry
na me all of una dey use compare devil abi... me wicked... okay sha.. Angry
Posted: at 29-11-2010 10:42 AM (13 years ago) | Hero
Reply
- Don-ziggy at 29-11-2010 10:43 AM (13 years ago)
(m)
na u use ur mouth talk am
Posted: at 29-11-2010 10:43 AM (13 years ago) | Upcoming
Reply
- Arabmoney2 at 29-11-2010 10:46 AM (13 years ago)
(m)
yabing dey game

Posted: at 29-11-2010 10:46 AM (13 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Skypon2002 at 29-11-2010 10:48 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: Kristiantus on 29-11-2010 10:14 AM
Quote from: Skypon2002 on 29-11-2010 10:13 AM
today na him i know say kris no like me,
so u go like make i go back to post 1

thank God say u no be m.o.d.
 Grin Grin Grin
you yeye ooo... i swear.. Angry
Grin Grin Grin

Posted: at 29-11-2010 10:48 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Skypon2002 at 29-11-2010 10:49 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: Don-ziggy on 29-11-2010 10:19 AM
appreciate person for once
no mind am
 Grin Grin

Posted: at 29-11-2010 10:49 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Skypon2002 at 29-11-2010 10:50 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: felixomosexy on 29-11-2010 10:25 AM
gud one bt na my tribe dey talk lik datooooooooooo
hahahahahaha
na him be say one of them from ur tribe com be dat.
by the way which tribe u be?
 Grin Grin Grin Grin

Posted: at 29-11-2010 10:50 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
- Skypon2002 at 29-11-2010 10:51 AM (13 years ago)
(m)
Quote from: florish4love on 29-11-2010 10:28 AM
hmmmmmmmm

skypon u try small
e dey funny nah

thankx jare, no mind my enemies of progress wey dey 4 this forum
 Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin Grin

Posted: at 29-11-2010 10:51 AM (13 years ago) | Addicted Hero
Reply
[1] 2 3 4 ... 6