lol,, Ok, since i returned the Bora, i had to enter a bus today to go home(hmmnn).As i enter, one guy no fit close him mouth.Guess he was flabbergasted by my beauty(wink)anyway, the guy suddenly started making a phone call
Boy: Hello, no no...that maga don pay..yes just 10k dollars and i dey find girl wey i go spend am on top..yes, no no..the 100 k dollars na next week i go cash am....NO..I NO CARRY MY Infiniti jeep..u know say i don tire for drive.I wan know wetin e feel like to enter molue....and so the conversation went..
Then all of a sudden, a man seated at the front ordered the driver to stop..The driver stopped and the hefty man came to the back and pulled the guy out of the bus.Everyone was surprised.come see beating..
MAN:the Maga don pay abi?You go talk am for police station.I am an officer of the law and i was duped last week by yahoo boys like u.God has caught u today.
See cry wey this boy dey cry.
Boy:im sorry sir..i no be yahoo boy oh..na because of this girl wey put me for trouble.I like the girl...i dey form the call oh..
Police man(still blowing him) You go talk dt one for station...u go produce that 100 k dollars wey mag don pay..(dragging him away) The boy started shouting at me to help him.
boy:help me sista..na because of u wey i enter this wahala.i look like person wey get infiniti jeep?
I just stood staring as the policeman dragged him away.Then all the people in the bus started looking at me with disdain.Some said i should have begged the police man on the boy's behalf..some said i be mami water..some said stuff... NA MY FAULT SAY THE BOY LIE? NA MY FAULT SAY I BE F*** GIRL? Did i do wrong? abeg tell me..
Posted: at 6-12-2010 07:59 PM (14 years ago) | Upcoming