confidential mata

Date: 25-01-2011 12:23 am (13 years ago) | Author: EFFICIENT INIODU
- at 25-01-2011 12:23 AM (13 years ago)
(m)
Presido Goodluck Jonathan yesterday go visit de Ajegunle area for Ikorodu wey flood scatter to use him own eye see wetin happen, plus promise to join hand and body with Lagos State Government to make sure say dem range de area make de flood no happen again. Presido Jonathan say him come Lagos to use him own ear hear de complain of the people wey de flood affect. Him promise say Federal Government go share money give some of the people wey de flood affect to help dem.

Commissioner for Environment, Muiz Banire say 1,500 house na im de flood affect for de area and na becos Lagos State Government been don warn people for area about de flood that’s why more houses for de place no turn swimming pool pass de 1,500 house.

Federal Executive Council yesterday approve make dem upgrade the Akanu Ibian airport, for Enugu state to change to International standard. Aviation Minister, Fidelia Njeze say aeroplane go soon start to fly for morning from de airport by December. Dem don lock de airport before becos of de re-arranging of de airport wey dem dey do before.
Senate yesterday reject one law wey Presido Goodluck Jonathan give dem to change something inside the 2010 election law book, the law suppose give INEC power to range the pattern of the election as dem like and affect something inside politik party dem primaries. Senate been don touchlite the law the first time but nah the second time dem eye open to some things wey dem no like nah wahala time.
Meanwhile  Senate talk talk person Ayogu Eze yan say as Senate no gree on top the law mean say dem dey use dem sense work well so dat e go better for everybody and no be say dem dey get wahala or bad bele with de executive.
PDP ogas for North-Central States don join mouth togeda beg before before Army Presido Ibrahim Babaginda and governor of Kwara State, Bukola Saraki to comot hand and head from the 2011 election. Dem sidon chook mouth for de mata for Senate Presido David Mark house yesterday. Plenti of dem chook mouth for de sidon say make all of dem for PDP support Presido Jonathan to come drag shirt to PDP Presido for the 2011 election.
EFCC don chook more hand for de trouser of before before Abuja minister, Nasir El- Rufai. EFCC talk talk oga, Femi nah im talk dis one, him bin say dem go start de mata inside high court for Abuja tomorrow.
State Security service, SSS don explain why dem hold the trouser of Oga Raymond Dokpesi , Oga for SSS wey dey chook mouth for de mata, Marilyn Ogar say dis one wey dem release Oga Dokpesi no mean say dem don leave am o, becos dem still dey touchlite de mata of de October 1 bombing.

Lawmakers group G11 for Ogun State house of Assembly yan say na house of reps dey put fire for de wahala wey dem get for dem State Assembly dem say dem no like as House of Reps tell Inspector General of Police to open the Assembly for the other group, G15. Deputy Speaker for the G11 group, Edward Odugbesan say House of Reps no follow law to tell police to chook hand for de mata and court don stop dem
Ekiti state Governor, Kayode Fayemi yesterday announce Ganiyu Owolabi as the new secretary to dem state government. Him still announce Yemi Adaramodu as him Chief of Staff plus Mojeed Jaminu as him Senior Special Assistant on media.
Some people don hala say China dey try to block United Nations to bring out report  card say dem use Chinese bullet shoot some peace Army people for Darfur but China say de report card no correct becos some things wey no be true fall inside.
United States don confirm say dem wan sell weapons plus helicopter and jet give Saudi Arabia for $60 billion but dem go still use like 30 days chook mouth and sense for de mata before dem sell de things to Saudi Arabia. US say if dem succeed sell de weapons e go be de biggest amount wey dem don sell and e go create like 75,000 jobs.   


Posted: at 25-01-2011 12:23 AM (13 years ago) | Newbie