PART 1: Lord na my 'Mai Nama' I no go ever fit say "my side dry"! He make me crash 4 where betta full ground, con carry me pass river wey no get current. He dey update my soul status, becos I be HIM name sake. He carry me pass highway of holy holy, sake of say HIM name dey d mata! See ehn, even if I waka pass where yawa dey gas, con even reach where dem dey kpai people; NOO SHAKIN!!! Notin dey happen!!
PART 2: Oghene Himself,tanda for my side Gidigba..(dem go fear now!) Ur 2 by 4 & ur staff dey cool my mind say:'my pikin, relax, notin dey happen, I dey tell u'. U don arrange correct Starch & Owho for table make I wack tight! All my enemies dey look with their okpolo eyes, u pour my head that oil wey get power well well. My cup just dey full throway anyhow. True true, yanfuyanfu life and mercy go dey follow me waka everyday I live and I go dey stay for paale bunk forever.............this is how we do it; gbaaabinski!
Posted: at 8-02-2011 03:01 PM (14 years ago) | Upcoming