One day my papa call me, my brother and my mama together come tell us say if we dream say them wan give us something for dream make we no collect, say na enemies wan give us bad things. He say if we dream that kind dream make we tell am and he go buy that thing wey them wan give us for dream for us. Two days later my brother sleep for night dey mention RICE! RICE!! RICE!!!, ma papa wake am say wetin dey happen, he say them wan give am rice for dream. My papa give am N500 say make he go chop rice. When I see say the thing dey work, the next day I start to dey shout MR BIGGS!!! MR BIGGS!!! for night. Ma papa say wetin, I say them wan gimme Mr Biggs for dream. My papa gimme N1000 make I take chop Mr Biggs. Na so I do wey I take buy my phone. But the one wey I do wey I take spoil everything na for one night wen I dey shout RANGE ROVER!!! RANGE ROVER!!! Ma papa wake up say wetin. I say them wan gimme RANGE ROVER for dream. Na hin my papa shout, "Hope say u collect am?" Na hin I say no. "Will u get back to bed and collect that thing STUPID BOY!!!"
Posted: at 18-05-2012 02:28 PM (12 years ago) | Upcoming
jossy4reall at 18-05-2012 05:25 PM (12 years ago) (m)
its gud and not pb4..........but ar u a boy or a girl?
Love or Hate me its ur Biz, I have more important things to think abt since u never gonna change me
Posted: at 18-05-2012 05:25 PM (12 years ago) | Hero
jossy4reall at 18-05-2012 07:22 PM (12 years ago) (m)
Quote from: chummyli on 18-05-2012 06:17 PM
Na pb4 ooooo! Jossy u don de lie n de ask ehim gender so u go leave jox woo her abi?
chummyli I don dey warn u ooo......no take Joxcel play wit me........as 4 d poster...her profile dey talk female but d joke come dey talk male... datz why I dey ask.........but I don understand say na C&P
Love or Hate me its ur Biz, I have more important things to think abt since u never gonna change me
Posted: at 18-05-2012 07:22 PM (12 years ago) | Hero