1) if you been the expect wetin go carry bishop akpors go prayer house for deliverance wen he they even conduct gve people..then u need deliverance..
2) if you the call you galfriend honey and she the call you one indian word like dat were una no even sabi wetin he mean..my guy ur deliverance due oh..abi u wan die with indian curse?
3) if terry g na your mentor ..you no well..weed boiz na dey una area abi na terry g alone u see?
4) if at age of 35 you still the single and you dey go club..you no well time were u for use search for a better husband na him u dey waste..i wonda if u no still marry at the age of 50 weda na vigil nites u go the go..
6) you only the go church when them get occasion.,no be ur fault e be like say you neva chop toothpick alone with pure water for child dedication b4..
7) if you the form big boy with 2 big china fones..e beta make u sell am buy one nokia torchlite phone for beating reduction reasons..(incase broda thief catch u na..2 china fones na die be dat na..)
8)if you they form yahoo boi just becoz say u dey 4 2go,,no be u 4ault u even sabi how to download am?
9) if you done they for naijapals reach 6yrs yet u still be newbies..na wa oh..but person na addicts na..
10) if the only post u sabi for naijapals na pb4 wen u don't even know the meaning..mtchew u dey write am becoz odas d write..mumuuuu
11)if you no sabi say numba 5 no they..na now u sabi? (wetin u d laff) abeg go 4 deliverance jor..
12) if you the form half cast coz ur mama is from sokoto and ur papa na calabar man..hmm no be half cast you be na fool cast..abeg meet akpors 4 deliverance..
13)if you tink say i no try..abeg go for deliverance..
Akpors no dey town now but him elders they around..just waka enter any barracks..go meet one soldier man, tell am *thunda fire, ,ur father *..i bet you your life will neva remain the same again..the blessings you wil recieve will relocate you to either mortuary, cemetary or emergency room for hospital...i go dey anxious to read una test-the-money oh sorry testimony..amen
Posted: at | |