little Akposaa, at his age of 5 (five years) still dey suck em mama Bosom .
na wa oh neighbors come dey complain say which kind boy be dis na,
NEIGHBOURS: Madam stop Bosom feeding dis boy now, abi na witch pikin be dis.
MAMA AKPOSAA: una no say na last born, i no fit stop na em go stop by em self.
one day Papa Akposaa come ves, e come say today today i must kill dis boy whether na send them send you come meet me and my wife.
PAPA AKPOSAA: i must kill you today and if ur mama no wan stop u Bosom i go kill both of una join.
AKPOSAA: why all of una dey querrl me say make i stop Bosom , even this my papa wey dey here (pointing at his father) still dey suck Bosom na me wey still be small boy no go suck.
WETIN SEF UNA CHOP WITCH, sofar my papa still dey suck, me too no go stop lailai.
Posted: at 4-12-2008 04:21 PM (16 years ago) | Gistmaniac
Hehehe... Kenny wetin u go chop for village when make u dey funny like dis 2day na... U try ooh... I don laff sotey i start to imagine aw d papa go feel when d pikin cast im dirty pant for outside warh... Funny indeed... u try...
Posted: at 4-12-2008 04:37 PM (16 years ago) | Gistmaniac
Kennycynth at 4-12-2008 04:46 PM (16 years ago) (f)
Quote from: orezo on 4-12-2008 04:37 PM
Hehehe... Kenny wetin u go chop for village when make u dey funny like dis 2day na... U try ooh... I don laff sotey i start to imagine aw d papa go feel when d pikin cast im dirty pant for outside warh... Funny indeed... u try...
ah orezooooh, e bi like say i don start to dey like you oh, for all dis praise wey you de give me so. my head don dey big pass ZUMA ROCK
Posted: at 4-12-2008 04:46 PM (16 years ago) | Gistmaniac