XMAS GET 2GETHER(PART II)

Date: 02-12-2008 2:04 pm (15 years ago) | Author: Cyntygal
[1] 2 3 4
- at 2-12-2008 02:04 PM (15 years ago)
(f)
fellow naija pals,
sorry for the first post.

like i said,
REASON: to thank baba God Almighty for keeping us alive 4rm January to December of dis 2008, and secondly some of us no sabi each other very well, while some no dey like to show their PIX some na small chirldren wey reach 12 years dem carry big uncle PIX carry cover face.

na em make me KENNYCYNTH come decide say make we have dis get 2gether so that we go meet and know each other very well.

DATE: 25th December, 2008.

VENUE: Women Development Centre opposite CBN, Central Business District, Area 11 Garki-Abuja

TIME: 5pm till dawn.

Transportation is free, just send ur name, address, email or Mobile Number to my profile box.

NB. restricted for members only.

don,t miss it be there.

Yours member,
KENNYCYNTH

Posted: at 2-12-2008 02:04 PM (15 years ago) | Gistmaniac
- orezo at 2-12-2008 03:09 PM (15 years ago)
(m)
U fit pay my Transport... Na arik i dey use oooh... But no wahala sha... I go show...
Posted: at 2-12-2008 03:09 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Grtmimshak at 2-12-2008 03:28 PM (15 years ago)
(m)
419...No God sidn dey look you...we all be naija....419 i say kennycinth..who gave you go ahead..Be warned..I can write a law soooth against you..or else you remove this post..419
Posted: at 2-12-2008 03:28 PM (15 years ago) | Newbie
Reply
- orezo at 2-12-2008 03:34 PM (15 years ago)
(m)
Bros easy na... Small tin like dis na i u wan carry go court...
Posted: at 2-12-2008 03:34 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Kennycynth at 2-12-2008 04:07 PM (15 years ago)
(f)
Quote from: Grtmimshak on  2-12-2008 03:28 PM
419...No God sidn dey look you...we all be naija....419 i say kennycinth..who gave you go ahead..Be warned..I can write a law soooth against you..or else you remove this post..419

bros you never jam at all.

incase you know no i dey work wit EFCC, my Papa na SSS and my Mama na Barrister for Supreme court don enter.
even for you calling me a 419 you are in trouble, u don enter one chance.

have ever seen a 419 pix and profile b4, and besides this is Jokes and entertainment forum where i can post funny things.
 
as i dey see you sef you resemble 419 person.
Posted: at 2-12-2008 04:07 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- kido123 at 2-12-2008 04:50 PM (15 years ago)
(m)
which airline go carry me come now? i dey come from bayelsa o.... and as kenny don get pikins , i don change my mind o ... new year don come...
Posted: at 2-12-2008 04:50 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- Kennycynth at 2-12-2008 05:06 PM (15 years ago)
(f)
Quote from: kido123 on  2-12-2008 04:50 PM
which airline go carry me come now? i dey come from bayelsa o.... and as kenny don get pikins , i don change my mind o ... new year don come...

come muskido no provoke me oh.
infact i don ves, i wan even follow Grin comot 4 dis forum.
for that bros wey put tire 4 neck like Obama to open em mouth call me 419,
i no do anything again, make una no come again, the thing wey dey pain me na de way i don take prepare 4 una
coming, all the money wey i  don spent finish.

all the TAKE AWAY gift, all the MR. BIGGS, FLY TICKET, even i make arrangment say una go follow me go see YAR'ADUA for ASO ROCK.

but now i don change my mind and know jupiter fits change am again.

inshort una don really miss no be small
Posted: at 2-12-2008 05:06 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- kido123 at 2-12-2008 05:17 PM (15 years ago)
(m)
chei! (bitting finger) , kenny me i no talk much o. i go come, ndo ... mabinu...... omo daadaa....etc . wetin make i carry if i dey come? one cooler go dey enof make i carry come to pack ogbono with fufu? as you don spend money well well , make the awuf no waste?   uhhh, uhnnnnn..... (sound of begging....).... Cool



Posted: at 2-12-2008 05:17 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- rezimero at 2-12-2008 06:04 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: Grtmimshak on  2-12-2008 03:28 PM
419...No God sidn dey look you...we all be naija....419 i say kennycinth..who gave you go ahead..Be warned..I can write a law soooth against you..or else you remove this post..419
bros that your tie resemble the one wey i take tie goat for my backyard Grin Grin Grin Grin
Posted: at 2-12-2008 06:04 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- dinho4lyf at 2-12-2008 06:31 PM (15 years ago)
(m)
which levels? all of una dey hash oo!!!!!!!!!!!!!
Posted: at 2-12-2008 06:31 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- DALETH at 2-12-2008 06:45 PM (15 years ago)
(m)
why be say na get 2gether party,why not depart 4rm me party
Posted: at 2-12-2008 06:45 PM (15 years ago) | Newbie
Reply
- lylawal at 2-12-2008 07:23 PM (15 years ago)
(m)
KENNY...
this kinda U go take us go see Umaru, wetin U say U de do for work for abuja? He he he... Abeg...

I hope say no be all those kinda gurls wey our Mama de talk say we no suppose follow. But on another note, if we come the pati, money de wey U go pay us, abi na jst dance eat and thats all. Nowadays, na to come party N pay wo!
Abj Big Gurls...
Posted: at 2-12-2008 07:23 PM (15 years ago) | Newbie
Reply
- Grtmimshak at 2-12-2008 10:09 PM (15 years ago)
(m)
If every one says its a joke..There is no problem. Can someone pls tell me whats this grin u re all saying is all about?
Posted: at 2-12-2008 10:09 PM (15 years ago) | Newbie
Reply
- rezimero at 2-12-2008 11:10 PM (15 years ago)
(m)
Quote from: Grtmimshak on  2-12-2008 10:09 PM
If every one says its a joke..There is no problem. Can someone pls tell me whats this grin u re all saying is all about?
bros wait make you grow up. when you don mature reach you go code Grin Grin Grin
Posted: at 2-12-2008 11:10 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- orezo at 3-12-2008 08:55 AM (15 years ago)
(m)
True talk... E no go fit know now..
Posted: at 3-12-2008 08:55 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- onyinyenaija at 3-12-2008 10:17 AM (15 years ago)
(f)
kenny...abeg try arrange one take away there 4me ...from ASO ROCK... i for like minister of external affairs... for some EXTERNAL BUSINESS...
Posted: at 3-12-2008 10:17 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- lylawal at 3-12-2008 10:29 AM (15 years ago)
(m)
External wetin? No kill KENNY market wo...! LOL!
Posted: at 3-12-2008 10:29 AM (15 years ago) | Newbie
Reply
- orezo at 3-12-2008 10:44 AM (15 years ago)
(m)
Onyi.... Na internal affairs minister u for go for na... So dat una go fit do some internal bizness transactions... Grin Grin Grin
Posted: at 3-12-2008 10:44 AM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
- HIGHD at 3-12-2008 02:45 PM (15 years ago)
(m)
december don come ooooooooooooooooooo.people dey find head,as much head go go as much money dem go get.me sef need head,i go send una my party address everything go dey .yardua sef go come.rsvp na mrs BIGGS
Posted: at 3-12-2008 02:45 PM (15 years ago) | Newbie
Reply
- onyinyenaija at 3-12-2008 02:53 PM (15 years ago)
(f)
Quote from: orezo on  3-12-2008 10:44 AM
Onyi.... Na internal affairs minister u for go for na... So dat una go fit do some internal bizness transactions... Grin Grin Grin

no na orezo... aaah! u don forget say EFCC dey for naija... na external biz transactions dey reign now...with external currency...u no understand ?... Grin Grin Grin
Posted: at 3-12-2008 02:53 PM (15 years ago) | Gistmaniac
Reply
[1] 2 3 4