Let Pray In Warri Style...

Date: 13-04-2012 6:02 pm (12 years ago) | Author: Fertymor Fatty
- at 13-04-2012 06:02 PM (12 years ago)
(f)
PSALM  23
1. Baba God na my shepherd, I dey kampe.
2. E make me sidon for where betta dey flow, come put me near stream make mai bodi thermacool.
3. E panel beat mai soul come spray am white, come dey carry me dey go through express road go
meet righteousness, sakeof I'm name.
4. Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join boko haram
reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko?
Na so dem dey like back bone dey comfort me.
5. You don prepare beta food on top table make I chop. All mai enemies dey look waa waa, **
mtcheeew long throat**. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. Mai cup na River Niger wey overflow im bank.
6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai tolai lai.
GOD ALMIGHTY NA YOU BIKO AMEN.

GOOD EVENING TO Y'ALL
DO HAVE A BLESSED DAY...

Posted: at 13-04-2012 06:02 PM (12 years ago) | Gistmaniac
- tesboy at 14-04-2012 01:57 PM (12 years ago)
(m)
pray for abuja ohhhh
Posted: at 14-04-2012 01:57 PM (12 years ago) | Upcoming
Reply