My 9ja piple,waitin dem dey yarn all d time about our sweety 9ja dey vex me no be small...na im i con say, make we use this area to yarn with "broken bottle" about waiting we think say na im be 9ja headdek,how we fit fight d headdek without panadol xtral but with native lef(agbo)
Abeg! no body go must yarn for here with english language atall,all una talk-talk go must be pidgin cos dis na "9ja head to head jam" and we comon flow na pidgin..and again,plenty of us fit to xplain our point wella for pidgin than english.
if u fit read pidgin but no fit rite am,make u scampa comot here cos no be by force say u go must post.
Posted: at 27-04-2010 02:02 AM (15 years ago) | Gistmaniac
but ejibond, you fail the test yourself ooo, becos you suppose use pidgin for the heading too, abi no be so?
Thank you for that sweet question cos i been they expect that kind question.. the thing be say,i no want any body to say them no undastand the topic b4 dem click am...that na why i use english and i don already pay fine for am.
Posted: at 28-04-2010 03:07 AM (15 years ago) | Gistmaniac
hey! whatz up bro. what the hell are yo yelling about? u better fasten ya seat belt.
Na people like you dey cos go slow for naija development...when the message say "Strictly pidgin"why u con dey post with english again...if you no sabi pidgin,make u scamper go english speaking thread na.
Posted: at 28-04-2010 03:11 AM (15 years ago) | Gistmaniac
hey! whatz up bro. what the hell are yo yelling about? u better fasten ya seat belt.
Na people like you dey cos go slow for naija development...when the message say "Strictly pidgin"why u con dey post with english again...if you no sabi pidgin,make u scamper go english speaking thread na.
u try wey u creat forum 4 peepo wey go sku 4 backyard
Believe it or not I Rule
Posted: at 28-04-2010 08:22 PM (15 years ago) | Gistmaniac