2.He make mi sidon for where betta dey flow Come put
me next to stream make mai bodi Thermacool.
3.He panel beat mai soul come spray am white, come dey lead
me dey go through express road of righteousness for sake of Hin name.
4.Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people borku,
come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi
dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so them dey back like bone dey
comfort me.
5.You don prepare Banga and starch make I chop. All mai enemies
dey look anyaa. You rub me for head wit Vaseline Intensive Lotion.
Mai cup na Ogunpa wey come overflow.
6.True true, betta life and mercy go come mai back till I quench.
And man go tanda for God house sotey sotey from Lai lai to lai lai.
GOD ALMIGHTY, NA YOU BIKO.
AMIN!
Posted: at | |