one guy wey be PRAYER WARRIOR for one church, you know as a prayer warrior him suppose to dey HOLY AND DECENT.
and the guy can claim to be holy no be small, na everyday him dey do fasting. so one day em BABE come visit him, the guy come say today today him must shake body bcos body no be wood.
shape shape na so e run enter one chemist shop and request for condom, as him tell the chemist boy to do quick, na so one of his fellow member come enter the shop.
the following conversation come take place:-
MEMBER: (greeting) bless brother
PRAYER WARRIOR: (shock and confused) ble ble bless you too
MEMBER: you look so pathetic, hope there is no problem?
as e wan reply the member na em the chemist boy come out wit the condom
CHEMIST BOY: bros see the condom oh, how many you want?
PRAYER WARRIOR: com on! i never mentioned condom, i said COMBATRIN(worm medicine)
CHEMIST BOY: bros no lie oh, na condom you first talk
PRAYER WARRIOR: (SHOUTING) are u deaf? COM BA TRIN, wat am i using condom for.
Posted: at 4-12-2008 03:34 PM (16 years ago) | Gistmaniac
babycross at 4-12-2008 03:48 PM (16 years ago) (f)
The guy no be correct naija. e for no shake like dead leave. i trust my people like grin, orezo and co
Posted: at 4-12-2008 03:48 PM (16 years ago) | Newbie